Venus (tori dem wey pipul biliv)
Venus na one Roman goddess wey dey kontro love, beauti, sex, mek wuman get belle, moni an propati, an mek pesin win for war. For di tradishonal tori wey Roman pipo dey tok, na Venus bi di papa papa of Roman pipo. Di tori tok sey na Venus boi-pikin, Aeneas wey leta bikom di fada of Roman pipo.
Julius Caesar klaim sey Venus na im great gran gran mama. Na bikos of Venus dem form meni rilijion festiva in Rome.
Di sem way Greek pipo tek hagrii an bilif di tori of di goddess Aphrodite; na so Roman pipo sef tek hagrii an bilif di tori of Venus. Di tori of Venus de plenti Roman buk an dia emeji. Wen di oyinbo pipo kom start to dey rid an stodi di Greek an Roman kolsho an rilijion, di pipo see sey na Venus de among di god- dem wey popula pass dorin di Greek an Roman empaya time. Di risin bi sey na Venus dey kontro love an sex. Dat is di risin wey Venus pikshon or emeji dey always dey naked.
Di orijin of di word
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di latin word wey dem yuz for di god Venus an di komon noun venus (Venus mins love for latin) kom from di one Proto-Italic form wey dem ri-form as *wenos (disaya). *wenos itsef kom from di Proto-Indo-European (PIE) *weny¹-os. Oda word-dem wey kom from dis word na: venustus (mek somtin fine), venustās (grace), venerius (mek somtin de sexual or erotic)
Di orijin of di god
[chenj-am | chenj-am for orijin]Of all di god wey Roman pipo no, na Venus di Roman pipo sabi wel wel .