Ukamaka Olisakwe
Ukamaka Evelyn Olisakwe (we dem bon for 24 October 1982) na Naija wuman wey dey rait buk, shot tori, an fim tori. For 2014, dem selekt am join 39 beta raita dem wey dem biliv say get promis for Afrika sotey dem neva rich 40 yias. Dem show dem for Africa39 projekt, an dem kari ha tori put for buk wey dem kol Africa39: New Writing from Africa South of the Sahara (wey Ellah Allfrey edit).
Pasonal laif an skul wey shi go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Olisakwe an grow for Kano State, wey dey Naija North. Ha papa an mama na pipul from Naija East. Shi du ha sekondri skul for Naija North, kom leta go Abia State Polytechnic for Aba go len Komputa Sayens.
Shi kom leta dey do PhD for University of South Dakota, for English dipatment. Shi dey fokos on hau to rid-an-rait tori (Literary Studies) an hau to rait krietivti. Di last big projekt wey she du (wey dem dey kol dissertation) na one tori-buk wey she kol The Things They Knew. Di tori na histri-fikshon - na say di tori base on ril tin wey hapun, but na stil fikshon. Di buk tok abaut Naija histri for ova 120 yias - from 1890 dem taim rich 2010 dem taim.[1]
Hau shi tek stat to dey rait tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Her fes buk wey be Eyes of a Goddess kom out for 2012.[2][3][4]
She don rait plenti shot tori an atikul dem, wey don show for blog an internet magazin dem like Olisa.tv, Saraba, Sentinel Naija an Short Story Day Africa. BBC sef don tok about her wok.[5]
Ha long rait-up dem (wey pipul dey kol “essay”) don show for The New York Times an oda magazin dem laik Nigerian Telegraph an African Hadithi. Na shi rait di fim tori for The Calabash - na TV show wey Obi Emelonye produs an direkt. Di TV show stat to show for Africa Magic Showcase for January 2015.
Shi dey manej blog for Writivism Mentorship Programme, wey be projekt wey Centre for African Cultural Excellence dey ron. Shi don also help train pipul for raitin wokshop for Lagos.
Shi bin bi guest an panel-memba for Ake Ats-an-Buk Festival an Hay Festival for 2014.
Dem selekt ha join di 39 raita dem wey neva rich 40 from Afrika an blak pipul wey dey ovasis, for Africa39 projekt - wey be Hay Festival an Rainbow Buk Klob projekt to selebret UNESCO World Book Capital 2014. Dem kari ha tori put for di Africa39 buk. Di tori wey shi rait - This Is How I Remember it - na tori abaut hau one smol gel bigin sabi wetin be lov for Naija. One pesin tok say di tori klia, swit, an na tori wey mek pipul wan rid mo. Anoda pesin tok say di tori strong, as e tok abaut yong lov, lie-lie an strong-wish.
For 2016, shi join International Writing Program for University of Iowa. For 2018, she win skolaship from Vermont College of Fine Ats to do MFA (Master of Fine Ats) for Writing an Publishing. For July 2020, shi stat her own magazin - Isele Magazine.
Taim wey she don tok an tich
[chenj-am | chenj-am for orijin]Olisakwe bin bi gest for 2015 Writivism Festival wey hapun for Kampala, Yuganda. Na dia shi tich big-buk klas (masterclass) for pipul wey wan sabi how to rait fikshon (story wey no be real).
For 28 May 2015, she do TEDx tok for Garki. Di nem of di tok na "Yu Fit Stop Di Nest Matanal Det Statistik" - dat one min say, na abaut hau to stop wuman from die wen dem wan bon pikin.
Hau pipul don sabi ha wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- 2014: Dem selekt ha for di Africa39 list - wey be 39 yong raita dem wey neva rich 40.
- 2014: Her buk Eyes of a Goddess enta This Is Africa list of Best 100 Books from 2010 rich 2014.
List of ha buk dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]Novel
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Eyes of a Goddess (2012)
- Ogadinma, or Everything Will Be All Right (2020)
Shot Tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Girl to Woman - Sentinel Naija, May 2011
- This is how I remember it - Africa39 buk, October 2014
Atikul dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Of Rising and the Home-Based Nigerian Writer - Saraba (2013)
- The North is Dead - African Hadithi (11 March 2014)
- Growing Up Fearful in Nigeria - The New York Times (1 December 2014)
- In Nigeria, an Election to Believe In - The New York Times (8 April 2015)
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Nigerian Author Ukamaka Olisakwe Successfully Completes Her PhD!". Brittle Paper. 2024-06-10. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Hay Festival". www.hayfestival.com. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ Amazon (2012). Eyes of a Goddess (in English). UK: Piraeus Books LLC. p. 304. ISBN 978-0985203818.
{{cite book}}
: CS1 maint: unrecognized language (link) - ↑ Better World Books (2022). "Eyes of a Goddess". www.betterworldbooks.com. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ cacedirector (2014-10-30). "2015 Writivism Mentors". Writivism (in Ínglish). Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Ukamaka Olisakwe: Breaking free". Bookanista. 2020-09-15. Retrieved 2025-04-20.