Tyla
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Saut Afrika |
| Fest nem | Tyla, Laura |
| Famili nem | Seethal |
| Wen dem bon am | 30 January 2002 |
| Ples wey dem bon am | Edenvale |
| Fest langwej | Zulu |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
| Wok wey e dey du | singa, pesin wey dey rait song |
| Pat of wok wey e put mind | singa |
| Wie e go skul | Centro Don Bosco |
| Wie e dey liv | Johannesburg |
| Wen e stat wok | 2019 |
| E pipul | Indian South Africans |
| Instrument | voice |
| Magnum opus | Water |
| Stai of song abi fim | amapiano, contemporary R&B, pop music |
| Record label | Epic Records |
| Official website | https://tylaworld.com |
Tyla Laura Seethal (wey dem bon for 30 January 2002), plenti pipu sabi am for im wok as Tyla, na South Afrika singa an song raita. Plenti pipu sabi wit popiano, wey bi pop an ampiano musik stai, plenti niuspepa kol am "Queen of Popiano".
Dem bon am an shi gro for Johannesburg, Tyla sign for Epic Rekod in 2021, afta im 2019 fest song, "Getting Late" sel wel for dia kontri. Dem sabi am wel for di wod wen shi rilis "Water" in 2023, wey rish top ten for di plenti kontris chat.
How shi stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Tyla Laura Seetha on 30 January 2022 insaid Edenvale, East Rand, to famili wey get Indian, Mauritania, Zulu, an Irish trace.
Shi gro insaid Johannesburg, Gauteng, an finish fom Edenglen High Skul in 2019, wia shi bi dia Head of Kolsho.
Awod an norminashons
[chenj-am | chenj-am for orijin]Tyla nem dey insaid singa wey fit bi winner for Best Afrika Music Performans insaid 66th Annual Grammy Awords. Shi don kolet two BET Awords, MTV Video Music Awords, an honorary Global Force Aword insaid di first Billboard R&B's No. 1's. Tyla nem dey insaid as most nominated artist at multiple aword ceremonies, Na shi leed di 18th annual Metro FM Music Awards wit six nominations, di 30th South African Music Awords wit five nominashons, an di 3rd annual Basadi in Music Awords wit five norminashons, bifor dat one shi win three awords.Na Tyla kolett awords wey plenti pas for 2024 BET Awards, wit American singas Usher an Victoria Monét at di Peacock Theater in Los Angeles, California, na shi bi di Best New Artist, an Best International Act. Shi get norminashons for South African Music Aword for Album of the Year, Soul Train Music Aword for Best New Artist, Brit Aword for Internashonal Song and Metro FM Music Aword for Song of di Year wit som oda ones.