Jump to content

Tosin Adarabioyo

From Wikipedia

Abdul-Nasir Oluwatosin Oluwadoyinsolami Adarabioyo (dem dey bon 24 September 1997) wey pipo no wel wel as Tosin na England futbola wey dey play sentra back for Chelsea futbol klub. Chelsea na one futbol klub wey de premiha ligi in England. Na Manchester City Adarabioyo tek start to dey play futbol. Na dia junior tim e dey play for bifor e kom enta Man City sinior tim in 2016.

For dat time, na Adarabioyo bi di playa wey e age smol pass wey wan play inside UEFA Shampion Ligi. Wen e dey Man city, na onli eight time e play for do klub in all do kompetishon wey di klub play. Man city kom leta boro West Bromwich Albion an Blackburn Rovers Adarabioyo mek e play smol for dem.

How e tek start life an go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for St Mary's hospitu wey de Paddington, London dem bon Adarabioyo but na Manchester e tek gro-up. Adarabioyo go Chorlton Hi-Skul an St Bede's kolej.

Adarabioyo futbol karia start wen e bi five yie old. At di age of five, Adarabioyo sahin for di junior tim of Man City. Na Terry John mek Adarabioyo sahin for man city wen e si am dey one lokal five-aside tornamet.

Adarabioyo fest dey train with Manchester United an Blackburn but leta chuz to dey man city.