Jump to content

Tejumade Alakija

From Wikipedia

Tejumade Alakija (wey dem born for 17 May 1925 – wey kpai for August 2013) na Naija wuman wey wok for govment, and shi bi di fest wuman wey bikom oga for ol govment wokas for Oyo State.

Tori abaut ha laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Princess Tejumade Alakija na pikin of Sir Adesoji Aderemi, wey be Ooni of Ife (na king for Ile-Ife). Dem bon ha for Ile-Ife, inasid Oyo State, for southwest Naija.[1]

Shi go Aiyetoro Primary and Central School for Ile-Ife, den she kom go Kudeti Girls School for Molete, Ibadan. Afta dat, she travul go London, England, go stodi History for Westfield College insaid University of London.[1][2]

From 1950 to 1951, shi len hau to tich for Oxford University, and shi pas ha tichin ezam. Afta dat, shi kom join Naija sivil savis, and dem send am go tich.[3]

Shi bigin tich for Queen's School, Ede (for Osun State), den leta wok for one niu skul wey dem kol Government Girls' Secondary Grammar School from 1951 to 1953. For 1953, she build ha own skul wey shi nem Girls' Secondary Grammar School.[4]

Shi leta wok for difrent govment ofis laik Ministry of Works and Ministry of Trade and Industries as Assistant Secretary. Shi olso tren pipul for wok insaid poblik savis and help du big govment jobs.

From 1960 to 1964, and leta from 1969 to 1972, shi bi Chief Investment Officer for Ministry of Trade and Industries, wey min say shi dey help Naija bring in niu kompanis and biznes.

Leta, for 1978, shi wok for Ministry of Health as Deputy Permanent Secretary, and for 1979, shi bikom Permanent Secretary for Ministry of Education. Afta ol dis, shi bikom fest wuman wey be hed for ol Oyo State sivil savants.[5] From 1993 to 1997, shi bi Pro-Chancellor for University of Abuja (na big oga wey help kontrol yunivasiti mata).

Princess Tejumade kpai for University College Hospital, Ibadan for yia 2013.[3]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1.0 1.1 vanguard (2013-08-23). "Alakija, first female Head of Service in Oyo, dies at 88". Vanguard News. Retrieved 2025-04-11.
  2. "Oyo's First Female Head of Service, Princess Tejumade Alakija Dies at 88!". The Street Journal. 2013-08-23. Retrieved 2025-04-11.
  3. 3.0 3.1 Professor Henry Louis Gates Jr.; Professor Emmanuel Akyeampong; Mr. Steven J. Niven (2 February 2012). Dictionary of African Biography. OUP USA. p. 155. ISBN 978-0-19-538207-5.
  4. "Ajimobi mourns Tejumade Alakija". Retrieved 2025-04-11.
  5. Adegbite, Ademola (2023-08-23). "Oyo govt celebrates first late female HoS, Alakija". Punch Newspapers. Retrieved 2025-04-11.