Tanimowo Ogunlesi
Tanimowo Ogunlesi (1908 – 2002)[1] na one big wumen raits aktivist for Naija. Shi lid di Women’s Improvement League and na one of di pipul wey help form National Council of Women’s Societies (NCWS) — di bigest wumen oganaizeshon for Naija.[2][3]
Tori abaut ha laif
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon ha for 1 December 1908. Shi go Kudeti Girls School, for Ibadan, and leta go United Missionary College (UMC) to len hau to tich. Shi bigin wok as ticha for CMS Girls’ Seminary School, for Lagos for 1934.
Dat same yia, shi mari J.S. Ogunlesi, wey also bi ticha. Wen her hosband get skolaship go London, shi folo am travul go UK. For 1946, shi kontiniu ha stodi for St. Andrew’s University, for Scotland, wia shi len abaut nursery skul edukeshon.
Shi and ha hosband kom bak to Naija for 1947, wen dem giv ha husband wok as Adult Education Officer for Western Region.
For 1948, shi opun di fest elementri bodin skul for Ibadan, wey dem kol Children Home School.
For 1959, shi bikom fest presido of NCWS (National Council of Women’s Societies).[4]
Shi fait mek wumen fit go skul and vote. Bot laik most wumen aktivists dat taim, shi no rili chalenj hau men dey kontrol haus mata.
Shi stil wok mek plenti wumen sabi domestic science (laik kukin, klinin, child care), and shi even opun home trenin skul to tich am.[5][6]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "OGUNLESI Gladys Tanimowo Titilola (Née Okunsanya)". 3 September 2020.
- ↑ "Foreign Data". Jet. Jet Magazine (Johnson Publishing Company): 40. December 16, 1961. ISSN 0021-5996.
- ↑ Banji Oyeniran Adediji (2013). DEEPER INSIGHT INTO NIGERIA'S PUBLIC ADMINISTRATION. AuthorHouse. ISBN 978-1-491-8347-25.
- ↑ "BiafraNigeriaWorld: Platform Shorten Link Terpercaya di Indonesia". BiafraNigeriaWorld: Platform Shorten Link Terpercaya di Indonesia. Retrieved 2025-04-25.
- ↑ Karen Tranberg Hansen; African Encounters with Domesticity. Rutgers University Press, 1992. p. 131–133.
- ↑ Hajo Sani (2001). Women and national development: the way forward. Spectrum Books. p. 32. ISBN 978-9-780-2928-29.