Sunkanmi Omobolanle
Hau e go bi
Sunkanmi Omobolanle (wey dem bon for 1 March 1981) na Naija fim aktor an daretor.
How im tek start life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Sunkanmi for 1 March 1981. E kom from Ilora wey bi one town in Oyo Stet in Naija. Sunkanmi papa na Sunday Omobolanle wey pipo sabi wel wel as Papi Luwe. Sunkanmi go Naijiria Militiri Skul bifor im enta Olabisi Onabanjo Yunivasiti wie e go rid Bizness Hadministrashon. In 2011, Sunkanmi mari Abimbola Bakare. Sunkanmi don akt an daret plenti Naija fims.
Fim-dem wey e de inside or daret
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ayomida (2003) as Cousin
Olaide Irawo (2007)
Gongo Aso (2008)
Eti Keta (2011) as Ajadi
Alakada 2 (2013) as Bayo
Head Gone (2014)
Jail (2017) as Kingsley
Upside Down (2018) as Obiagu
Ofeefe (2019) as Delani
Kakanfo (2020) as Tolu
A Dream Called Death (2020) as Tony
The Alternative (2022) as Lanre