Jump to content

Stella Oduah

From Wikipedia

Stella Oduah Ogiemwonyi (Dem bon ha fo Oduah family January 5, 1962), na Nigerian Senator and former Minista of Aviashon. Dem mek ha minista fo July 2, 2011 and na fo Aviashon Ministry Dem put ha fo July 4, 2011. Dem drop Stella as Minista of Aviashon fo February 12 2014. Shi tek aktive pat fo di politikal campaign of former President Goodluck Jonathan, where shi bi di campaign Direktor fo Administrashon an Finance. Fo 2013, shi de among pipul wey president Jonathan chose to attend di Papal inaugurashon of Pope Francis.Di orda pipul wey go na David Mark, President of di Senate na Viola Onwuliri, Foreign Minista. Fo February 23 2017, Punch Newspaper repot sey, di Federal high court fo Lagos freeze Stella Oduah four compani account becos dem dey owe plenti moni wey reach $16,412,819.06 and N100,493,225.59. Stella Oduah don do som thing wey don cus kontrovasy, wan of Dem na di plenti govment moni wey shi tek buy BMW bullet proof car-dem an shi no follow due process tek buy the car-dem. Dem still tok sey shi lai abaut di MBA degree wey shi sey from St Paul's College. Di SaharaReporters, don repot fo Jan 6th 2014 say St. Paul's College, where Mrs. Oduah claim sey she study for bachelor and master degrees, sey dem no award her MBA sey di university no dey do graduate programme.

Senate kariar

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo 2015, dem elect Stella as di Nigerian Senate to represent Anambra North Senatorial District.Stella bi one of di seven women elected to 8th National Assembly.