Simon Ajibola
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Simon |
| Ples wey dem bon am | Kwara |
| Fest langwej | Yoruba Langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Yoruba Langwej |
| Wok wey e dey du | politician |
| Post wey e dey | member of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria |
| Wie e go skul | Ahmadu Bello University |
| Party wey e dey for politis | Peoples Democratic Party |
Simon (wey stil bi Simeon) Ajibola na di pesin wey bikom Senator for Kwara South Senatorial District for Kwara State for June 2004, and dem elekt am again for 2007. E dey for People’s Democratic Party (PDP).
Hau e gro and skul wey e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ajibola go Ahmadu Bello University for Zaria, and for 1979, e finish skul for one kos wey dem dey kol Quantity Surveying.
Hau e tek enta and du politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 1994 to 1995, dem elekt Ajibola as Delegate for the big mitin wey dem do to tok abaut niu law for Naija (National Constitution Conference).
Wen General Sani Abacha bin plan to chenj pawa giv civilian, Ajibola kontest for Senate sit onda one pati wey dem kol United Nigeria Congress Party (UNPP). Ivun as e bi say pipul no tu biliv say e go win, Ajibola stil win. Bot as Abacha kpai for June 1998, dem kansul di eleshon kpatakpata.[1]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Tunde Sanni (Jun 7, 2010). "Battle Before a Deposed Senator". ThisDay. Archived from the original on 2012-03-06. Retrieved 2025-05-16.
