Jump to content

Simi Johnson

From Wikipedia

Simisola Olayemi Onibuwe Johnson (1929 – 2000)[1]na one of di fest wuman dentists for Naija and strong wumen advocate. Shi serve as Minister for Social Development and Culture for Naija Sekond Ripoblik.

She also bi: Chairperson of Allied Bank, Leader of di Lagos State branch of National Council of Women Societies, and fellow of di National Postgraduate Medical College of Nigeria.

Tori abaut ha laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for Lagos Island. Ha papa Alfred Latunde Johnson na loya and fest oga kpatakpata of National Bank of Nigeria. Ha mama wey bi Harriet Susan Johnson (wey im papa nem na Crowther Nichol) kom from famili wey Ajayi Crowther and Herbert Macaulay dey insaid.[2]

Shi go CMS Girls' School, for Lagos, den travul go UK. From 1954 go rich 1957, shi stodi for Sunderland Technical College and Durham University. Shi finish skul as dentist for the sem taim wit Grace Guobadia - two of dem bi fest Naija wuman wey kwolifai as dentists.

Simisola get Bachelor of Dental Surgery (BDS) and leta bikom orthodontist afta shi atend Royal College of Surgeons, for Glasgow.[3]

Shi bi one of di wumen wey help build govment koneshon wit wumen oganaizeshons. Shi lid Naija delegation for Third World Conference on Women for Nairobi, for Kenya for 1985.

Shi hed wumen advisory komiti wey rekomend say Ministry for Women Affairs sopoz dey.[4]

As e bi say e no hupun imidiatli, for 1989, Naija govment form National Commission for Women, wey Maryam Babangida sopot.[5]

Simisola Johnson na di fest pesin wey stat women empowerment and healthcare. Shi help push for ikwol paticipeshon of wumen for national development and beta laif for wumen for Naija.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Reuben Abati (13 September 2008). The Whole Truth: Selected Editorials of the Guardian (1983–2003). Guardian Newspapers Limited. p. 419. ISBN 978-9-782-0306-34.
  2. "Dr Simisola Johnson". The Women of Color Arts and Film (WOCAF) Festival Atlanta.
  3. "Nigerian Women and the Obasanjo Regime". Amina Salihu, DPMF Publications. Archived from the original on 2019-07-01. Retrieved 2025-04-25.
  4. "1985 World Conference on Women". Fifth Women’s World Conference.
  5. "The life and times of Maryam Babangida". Vanguard News. 2009-12-29. Retrieved 2025-04-25.