Shoemaking
Na how dem dey mek shu na im dem dey kol "shoemaking". Na one bai one na im dem dey yuz hand tek mek shu, an na join bodi of shumeka/kobla(pesin fit kol am kodwaina) dey du am. Plenti plenti pipul wey bi Oga, join man an pipul wey dey len wok for 18 senturi dey join hand togeda wok for inside one shop bot dem go share di wok bitwin dem sef. Wen kostoma kom inside shop, dem go mesho di pesin.Afta dem don mesho di pesin, dem go du shu bot di kostoma go go kom bak kom kolet e niu shu. Na efribodi wan get shu, an di shu dey kos rish di moni wey pesin dey kolet if e wok for one ful day as joinman. Pipul wey dey mek shu mek plenti moni for 18 senturi an som pat of 19 senturi bot trobul stat wen big big kompini kon stat wok wen 19 senturi don almos end. Kompini wey dey yuz mashing tek du plenti plenti shu at wans don dey mek di wok taya pipul wey dey yuz ordinari hand tek du am, even sef di kompini dem dey shuk eye for di smol smol tins wey pipul wey dey yuz ordinari hand dey du shu no dey fitdo wel wel. Christopher Nelme, of England bi di fest pesin wey dey mek shu for Amerika. E traful on top of wota(sea) from Bristol go Virginia for 1629.