Sharon Ezeamaka

Sharon Chisom Ezeamaka na Naija fim aktres and shi bi feminist (wuman wey dey fait fo wumen rait).[1] Shi stat to akt fim sins shi smol, and shi don akt fo TV show dem like Shuga, Kala & Jamal, and Dorathy My Love.[2]
No bi onli fim shi dey du, shi stil bi produsa, model, and TV presenta.
Tori abaut ha laif
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2012, Ezeamaka tok for one intaviu wit Showtime Celebrity say pipul stil dey trit ha laik smol pikin, ivun do shi don rich 20 yias. Shi yan say:
"A don dey akt fim sins wen a bi 5 yias, bot ivun as a bi 20 nau, pipul stil dey si mi as dat smol pikin. So, a tek brek fo two yias mek a trai du oda tins, gro smol, and len oda tins wey dey midia (TV, radio, and magazin wok). A wok fo fashon magazin for laik one yia, na FAB magazin. Afta dat one, a rest smol bifo a join M-net sho, The Johnsons. For The Johnsons, a dey play one smol pikin wey bi 15 yias".[3]
Shi kon ad say shi no get taim for boiz at ol.[4]
Fim wey shi akt
[chenj-am | chenj-am for orijin]| Yia | Fim | Wetin she akt insaid | Di kain fim | Wia dem get di tori |
|---|---|---|---|---|
| 1999 | Narrow Escape | child actress | Film | |
| 2000 | Dear Mother | child actress | Film | |
| 2004 | Little Angel | Home movie | ||
| 2004 | Burning Desire | Home movie | ||
| 2004 | Burning Desire 2 | Home movie | ||
| 2005 | Dorathy My Love | Home movie | ||
| 2005 | Dorathy My Love 2 | Home movie | ||
| 2007 | Secrets of the Night | Home movie | ||
| 2007 | Secrets of the Night 2 | Home movie | ||
| 2016 | Kala & Jamal | Bolade | TV series | |
| 2013–18 | Shuga | Princess | TV series |
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "I don't have time for men – Sharon Ezeamaka, actress". Sun News Online. Retrieved 15 April 2025.
- ↑ Nation, The (2015-05-29). "I'm still too young for a relationship –NOLLYWOOD ACTRESS SHARON EZEAMAKA". The Nation Newspaper (in Ínglish). Retrieved 2025-04-15.
- ↑ "At 20, people still treat me like a little girl - Sharon Ezeamaka". Vanguard News (in Amẹ́ríka Ínglish). 21 December 2012. Retrieved 15 April 2025.
- ↑ sunnews (29 October 2017). "I don't have time for men – Sharon Ezeamaka, actress". The Sun Nigeria (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 15 April 2025.