Selebobo

Udoka Chigozie Oku, wey plenti pipu sabi im stej nem Selebobo, na Naija singa an song raita, na bifor bifor e dry onda Made Men Music Grup, plenty pipe sabi am wen e du "Yoyo", Selfie, an waka waka song, e du song wit Flavor N'abania, Yemi Alade, Tekno Miles, Emma Nyria an Iyanya. Im nem dey insaid produsa wet fit win do produsa of di year awod for 2018 Di Headies.
How e ten stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Udoka Chigozie Oku on 29 July 1992, to mama an papa wey bi Igbo fom Enugu Stet, Nigeria. Na im dey nomba eleven insaid twelve pikin wey dia mama an papa bon. One of im brodas, Okechukwu Oku, na produsa wet pipu sabi wel wel, dia papa, Goody Onu, na singa wet sand uze guitar wel for smol smol shos e dry du insaid 1970's. Na im papa tich am how to use guitar an som oda tins wey dem dey uze pley musik. Wen e dey twelve years old, e don sabi uze keyboard dry pley musik.
Edukashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Oku go primari an sekondri skul insaid Enugu Stet, e leta go Nnamdi Azikwe Universiti, wey dey Akwa, Anambra Stet, an e kolet bachelor digre in fine Arts fom di skul.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]To stat im wok wel, e stat to rait an produs songs, na 2013, e fest du im single, "Yoyo", wit J Martins, smol taim afta dat one, dem sign am to Made Men Music Group (MMMG), wit Tekno, Iyanya an Emma Nyra. Wen e dey onesy MMMG, dem sabi am as Mixx Monsta, na im produs [{Yemi Alade]] song, "Johnny", wey plenti pipu sabi.
Oku komot for MMMG in 2019, to go stat im own rekod label, "Vault".
Na Oku produs Rudeboy's 2021 solo album, Rudy Kill Us.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]Oku don win difren an plenty awods. Som of dem na bez kolaborashon of di year, Bez produsa of di year fom Nigeria Entertainment Awod, Bez Pop Artist for Nigeria Entertainment Awod an Bez Artist of di year fom di City People Entertainment Awods.