Jump to content

Sandra Aguebor

From Wikipedia

Sandra Aguebor abi Aguebor-Ekperuoh na Naija mekanik wey pipul sabi as di fest wuman mekanik for Naija.[1] Shi na di pesin wey stat one grup wey dem dey kol Lady Mechanic Initiative. Di grup dey tren wuman wey don sofa sexual abuse or wuman wey no get moni, mek dem len mekanik wok tek stand for dia leg.[2]

Hau shi tek stat laif and go skull

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Sandra Aguebor for 1970s for Benin City, for Naija. Ha papa and mama na Mr. & Mrs. R.A Aguebor wey don kpai.[3] Shi stat pramari skul for Ivbiotor Primary School, and leta go St. Maria Goretti Grammar School, wey stil dey for Benin. Afta dat, shi go Benin Technical College wey help am build ha hand-wok skil wel.

Shi leta finish from Auchi Polytechnic for Edo State. Shi stil get one digri from Goethe Institute, wey bi one German skul wey dey Lagos.[4][5]

Hau shi tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta shi finish skul, Sandra bigin wok for Edo Line and Nigeria Railway Corporation.[6] Shi leta opun ha own mekanic wokshop. Ivun wen dem skata ha wokshop, Sandra no gri giv up. Shi stat to dey yus mobile wokshop - dat na say shi go mit pipul wey car spoil for Lagos expressway, du am shap-shap.[7]

From dia, shi opun two more wokshop for insaid Lagos.

Nau, shi dey yus ha taim to tren yong wuman, kari dem komot from strit, and tich dem beta skil, espeshiali hau to ripia moto.

Sandra don tok say as shi bi wuman, e had wel-wel to mek pipul tek ha sirios. Shi tok say shi dey put five taime more efot pas men jos to get respekt. Shi no laik say dem dey always kol ha "lady mekanik", insted of jos "mekanik", laik dem dey kol di men.[8]

For 2015, Al Jazeera produs one film abaut ha laif. Dem kol di film Sandra Aguebor: The Lady Mechanic. Di film win award for New York Film Festival.

Shi leta get COWLSO awod nomineshon - na awod wey Lagos State government stat for 1974, to selebret pipul wey dey help improv di sosaiti.

Shi win Inspirational Wuman of the Year Award, wey Dolapo Osinbajo and Govno Akinwunmi Ambode giv ha. Dem tok say Sandra yus ha talent and skil tek chenj sosaiti for beta, ivun for wok wey men plenti dey du.

Shi stil kolet one National Merit Award from Naija Govment.[9]

Sandra tok say shi don tren more dan 700 wuman mekaniks. Shi tok dis one for graduashon seremoni wey dem do for 50 wuman mekaniks. Shi don mari and she get children.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "We Are Together: Fixing Cars and Women's Lives En Route". commondreams.org. Retrieved 2025-04-21.
  2. "Sandra Aguebor: Lady Mechanic". Aljazeera]]. 2015-09-15. Retrieved 2025-04-21.
  3. "My Nigeria - Sandra Aguebor: Lady Mechanic | Al Jazeera Content Sales". contentsales.aljazeera.net. Retrieved 2025-04-21.
  4. "Sandra Aguebor". edoworld.net. Retrieved 2025-04-21.
  5. LadyMech. "Everything You Should Know About Sandra Aguebor, Nigeria's First Female Mechanic | Lady Mechanic Initiative". Retrieved 2025-04-21.
  6. "Sandra Aguebor". edoworld.net. Retrieved 2025-04-21.
  7. LadyMech. "Everything You Should Know About Sandra Aguebor, Nigeria's First Female Mechanic | Lady Mechanic Initiative". Retrieved 2025-04-21.
  8. Damilola, Odufuwa. "Sandra Aguebor, The First Female Mechanic In Nigeria, Is Teaching Women How To Fix Cars". Konbini. Archived from the original on 2017-11-11. Retrieved 2025-04-21.
  9. Eribake, Akintayo (3 August 2014). "I abandoned Switzerland residency for lady mechanic job". Vanguard. Nigeria. Retrieved 20 April 2025.