Jump to content

Salima Mukansanga

From Wikipedia

Salima Mukansanga (dem bon am for 1988) na international football referee fom Rwanda. Sins 2012, FIFA don list ha nem as one of dia internashonal referees. Shi olso officiate for di 2019 FIFA Women’s World Cup wey hapun for France.

How shi tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For di beginnin, Mukansanga lik basketball, but shi leta enta futbol wok afta dem tel ha say shi too smol to join di nashonal onder-17 basketball teem.

Afta shi finish sekondri school, shi go meet di Rwanda Football Federation say shi wan len how to bi referee. But dem tel ha say she stil smol dat taim. Leta on, afta shi don uze her own taim len do lors of futbol by hasef, dem finally allow ha join dia refereeing course.

Mukansanga leta go University of Gitwe, wia shi stodi nursing and midwifery.

Wen shi fest stat di referee wok, shi dey officiate men’s lokal amateur futball matches and wumen’s nashonal sekond division matches for Rwanda.

How ha wok don go far

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2022, Mukansanga mek histri as shi bi di first wuman wey go do referee for di African Cup of Nations (AFCON). Shi leed team wey all of dem na wumen:

.Fatiha Jermoumi fom Morocco,

.Carine Atemzabong fom Cameroon,

and Bouchra Karboubi from Morocco wey be di VAR offishial.

Shi don olso officiate for Olympics, FIFA Women’s World Cup, Africa Women Cup of Nations, and CAF Women’s Champions League.

Dat sem 2022, shi bi one of di three wumen referees wey FIFA chuz to officiate for di FIFA Cup wey hapun for Qatar. On 22 November 2022, World. Mukansanga bikom di first African wuman to officiate for men’s World Cup match. Shi akt as fourth official wen France, wey bi di defendin champion, beat Australia 4–1.

Bikos of ol ha fain wok, BBC put ha nem for di 100 Wumen of the Year list for December 2022.

Leta, on 9 January 2023, FIFA stil appoint ha to join di officiatin teem for di 2023 FIFA Wumen’s World Cup wey hapun for Australia and New Zealand.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]