Jump to content

Sadiq Dada

From Wikipedia

Sadiq Abubakar Daba abi Sadiq Daba (1951/52 - 3 March 2021) im bi Naija aktor and broadcaster bifore i die. In 2015, im win Africa Movie Academy Aword For Best Actor for his role as "inspector Waziri" in October.

Im du secondary edukashon for St. Edward's Secondary School, bifore im con go Ahmadu Bello University in Zaria.

Dada don work as broadcaster for Nigeria Television Authority. Pipu stat to dey no am in di Late 1970's im feature inside Cockcrow at Dawn.In 2018 dem give am di title “Garkuwan Nollywood,” wey mean sey na him bi di "Shield of Nollywood" by those wey get mouth for di industry

Daba announce sey dem diagnosis am of leukemia and prostate cancer in 2017 and meni pipu support am with money, Pipu like Josephine Obiajulu Odumakin, MabelOboh Center For Save Our Stars (MOCSOS).On 3 February 2018, Daba join Project Pink Blue to waka against cancer to commemorate World Cancer Day. Im die 3 March 2021 for Ayinke General hospital in Ikeja, Lagos.