Jump to content

Ruth Rubin

From Wikipedia

Ruth Rubin ( dey bon am September 1, 1906 an e kpai on June 11, 2000) na Canadian-Amerika wuman wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. E stil bi singa, poet, an pesin wey sabi Yiddish kolsho an muzik.

How e tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ruth Rubin ril nem wen dey bon am na Rivke Rosenblatt. Na for Montreal dey bon am in 1906. Rubin sabi spik three langwej: Yiddish, Inglish an French. Rubin papa an mama komot from Bessarabia in Canada. Dat ples bifor na pat of ples wey Russian govamet dey kontro. Rubin at list get one junior sista lol Esther. E go di poblik skul wey dedi siti an also di Peretz Shule. Peretz Shule na skull wey Yiddish pipul dey go an na for dia Rubin fest tek lisin to Sholom Aleichem spikin in 1915. E luv wetin Sholom Aleichem too wel wel at dat time. Wen e go New York in 1924, e stodi muzik an stil go evenin klass at Hunter College bikos e dey wok as Seketri an short-hand tisha.

How e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Araund 1935, Rubin like to stodi an rekod how dem dey du tins for loyal way in Yiddish an dis one mek go find Chaim Zhitlowsky. Chaim Zhitlowsky na sabi Yiddish wel wel as na raita for "Guidance". Rubin stat to dey du e risach for YIVO Institute for Jewish Risach, di New York Poblik Librari, an di ples wey Jewish Theological Seminary dey kip old buks. Apart sey e dey tish muzik an poem for Yiddish skul, Rubin still dey poblish buks. Wen Wold war II stat, Na Rubin dey intaprit leta an tori wey dey kom from ghetto an prisin kamp from Yiddish langwej to Inglish langwej.

Araund 1947, Rubin stat to dey go mit pipul wey de Jewish komuniti wey kom to New York siti, Montreal, an Toronto wey run komot from dia ples bikos dey no wan kpai bikos of di kili-kili of Jew pipul. Rubin wok rili dey impotat bikos e stat to dey rekod an kip Yiddish song an Yiddish tori wen pipul no dey too notis am dat time.