Running Eagle
Running Eagle (Pi'tamaka) na wuman from one Native American pipul wey dem dey kol Blackfeet. Shi bi worio and ivun bi war lida. Pipul sabi ha wel bikos shi sabi fait batul and win.
Hau shi tek grow-op
[chenj-am | chenj-am for orijin]Running Eagle na di fest bon for ha papa and mama pikin dem. Dem dey liv for Southern Alberta, Canada. Ha oda nem na “Brown Weasel Woman.” Shi bi from one part of Blackfeet pipul wey dem dey kol Piikáni Piegan. Shi get three yonga sistas and two brodas.
Wen shi stil smol, shi no tu laik play wit gels. Shi laik folo bois play. From wen shi bi 12 yias old, shi bigin wia klot wey bois dey wia.
Ha papa kom tich ha evritin wey im dey tich ha brodas—hau to hont animal and hau to fait. Ha mama no tu laik am, but ha papa no stop.
E no tu tey, shi bigin folo dem go hont buffalo.
One day, dem go hont, bot enemi pipul (Assiniboine) atak dem. As evribodi dey ron, ha papa horse fol daun bikos bulet toch am. Running Eagle kom trowey di mit wey shi kari, ron insaid denja, kari ha papa klaimb ha own horse and save ha papa laif.
Bikos of dis brave tin wey shi du, ha pipul sing Vitri Song for ha, and du dans wey dem dey kol Scalp Dance. Bot som pipul stil no hapi bikos dem fie say oda wumen go stat du laik ha and foget dia waif wok.
Leta, ha mama bgin sik. Ha papa kpai for one war wit anoda pipul (Crow). Wen ha mama hie say her papa don kpai, shi tu kpai. Running Eagle kom rimen as hed of di haus. Shi no laik to stay haus dey do domestik wok, so shi bring one widow wuman mek shi help tek kia of ha yonga ones and klin haus.
Hau shi tek win for war
[chenj-am | chenj-am for orijin]One day, som worios from ha pipul go plan to fait Crow pipul and kolet dia horse. Running Eagle folo dem go, kari ha papa old gon.
Di lida si ha and tok say mek shi go bak. Shi say no. Di man ivun say if sh no go bak, e no go do di plan again. Shi tel am say if dem no go, she go go alone. Bikos of dis strong-hed, dem alau ha folo.
For di fait, shi kapsho 11 horses for ha pipul. As dem dey go bak, shi stay awake dey gad dem wen di men slip. Two Crow men kom trai stil bak di horse, bot shi kach dem. Again, pipul hail ha. Bot stil, som pipul no laik wetin shi dey du.
Di eldas kom tel ha to du somtin wey dem dey kol vishon kwest. E min say shi go enta bush alone for four days, no chop, and wait mek spirit show ha ha fusho.
Na onli men dey do dis kaind tin nomali, bot Running Eagle agri. Wen shi kom bak, shi tok say shi si vishon of di sun. Di sun tel am say e go giv ha pawa to win batul—if onli shi no slip wit eni man.
Afta dat, dem invait ha join sekond war grup and join Medicine Lodge Ceremony—na onli men dey join dat one bifor. Di pipul chif wey dem dey kol Lone Walker kom giv ha di nem “Running Eagle.” Na onli gret worios dey get dat nem, and na shi bi fest wuman wey eva get am.
Dem stil alau ha join one grup wey bi Braves Society of Young Warriors.
Afta ha pipul bigin respet ha wel, shi lid meni batuls and hontin trips. Shi no mari. Ivvn dou shi dey dres laik man and fait laik worio, shi stil dey kuk for di men and mend dia shoes (moccasins), bikos na onli wumen sabi do dat one dat taim.
Hau shi tek kpai and wetin piul tek rimemba ha
[chenj-am | chenj-am for orijin]Running Eagle kpai somtaim afta 1878 for war against Flathead worios. Di worio wey kil ha na one man wey dem dey kol Zamalya. Dem hie say na wuman dey lid di worios, so dem taget ha and bit ha from bak.
Blackfeet pipul tok say maybe shi kpai bikos shi brek ha promis to di sun—say shi leta slip wit one man from war grup, and di sun stop to protet ha.
Ivun dou shi kpai, shi kpai laik hero and worio, as shi dey du wetin shi lov.
Today, dem dey kol one lake for Montana, USA: Pitamakan Lake, to honor ha. Ha pipul stil dey liv for risav area for America.
Oda joke wit ha nem
[chenj-am | chenj-am for orijin]For America, pipul dey joke say if dem giv politishian nem laik “Running Eagle” abi “Walking Eagle,” e min say “na bird wey don chop tu moch lai-lai wey no fit flai again.”
Di joke no rili get enitin to du wit Running Eagle (Pi’tamaka) own nem—na jos say e hapun laik dat.