Roseline Adewuyi
Roseline Adebimpe Adewuyi na Naija soshial eduketo, jenda advoket, and feminist.[1][2] For 2020, dem selet ha among 60 wuman wey dey do beta wok for Naija as pat of Naija 60 yias indipendens selebreshon wey BusinessDay Women’s Hub du. For 2018, shi bi Dalai Lama Fellow bikos of di wok wey shi dey du for gel pikin divelopment.[3][4]
Skul wey shi go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Roseline kom from Ogbomosho for Oyo State. Shi stodi French and im finish with Fest Klass for Obafemi Awolowo Yunivasiti. Roseline stil get Masta Digree in French wey shi kolet with Distinction from Yunivasiti of Ibadan.[5][6]
Wok wey e du and hau sti tek fait for wumen raits
[chenj-am | chenj-am for orijin]Roseline get strong mishon to helep gel-pikin wey strong, get konfidens and fit stand by diasef. Roseline dey fait mek gel-pikin sef dey do evri-tin wey boi sef dey du.[7]
For 2018, Roseline stat to dey rait wikli atikul for im website abaut wetin Afrika gels dey fez. Roseline dey also du waka about from Skul to slul, go mit gels for sekondri skul, tish dem tins wey go helep dem be lidas wen dem gro up.
Wen Roseline dey du NYSC, e get awod as best kopa for Kwara Stet, bikos of di komuniti wok wey Roseline du.
Sins dat times, meni intanashonal program don pik am as fellow. Roseline don go France, Rwanda, Ethiopia, Ghana, and United States for difrent programs.
From 2019 go rish 2020, Roseline wok for African Union as French Translator.
Roseline don risiv plenti rekognishon: Member of Commonwealth Youth Gender Equality Network, ONE Champion, MCW Fellow, Dalai Lama Fellow, Award for Outstanding Social Innovator in Education by Ideation Hub Africa, Represent Nigeria for La Citoyenne Human Rights Program wey French Embassy for Naija sponsor.[8][9]
For Naija 60 yias selebrashon, dem stil put ha nem among “Di 60 Wuman Wey Dey Do Big Big Tins” by BusinessDay Women’s Hub.[10]
For 2023, Roseline reprisent Naija for United Nations Graduate Study Programme for Geneva, for Switzerland, bikos of ha wok as French Translator and NGO wok.
Shi stil bi one of Top 50 Finalists from 176 kontris for di Global Student Prize.
For 2024, United Nations show her insaid one poblikeshon wey dem kol "Breaking Gender Barriers through Education", to selebret hau shi dey yus edukeshon tek sopot jenda ikwoliti.[11]
Buk wey shi rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]Roseline don rait more dan 10 buks.[12][13]
Some buk wey shi rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]- La Conception du Mariage Africain: Une Lecture de Riwan ou Le Chemin de Sable par Ken Bugul, wey dem poblish for March 2022.
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Gender advocate, Roseline Adewuyi, celebrates three years of blogging". Tribune Online. 2021-09-01. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ NewsDirect (2022-04-15). "Education, key to gender-inclusive society — Roseline Adewuyi". Nigeriannewsdirectcom. Archived from the original on 2023-02-09. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Adewuyi: Being gender advocate is not for the faint hearted". The Guardian Nigeria News - Nigeria and World News. 2021-06-05. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Spotlight on France - France encourages new generation of global citizens through Labcitoyen programme". RFI. 2018-07-11. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "#Interview | "My Advocacy Is Focused On Breaking Sterotypes" - Roseline Adewuyi". Women of Rubies. 2021-06-01. Archived from the original on 2021-09-30. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Here Are All The Amazing Things Roseline Adewuyi Is Doing To Advocate For The Girl Child". Woman.NG. 2021-10-14. Archived from the original on 2021-11-15. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ Crown, Adejola Adeyemi (2021-10-16). "Abandon Societal Constructs Inimical To Your Personal Growth - Gender Advocate, Roseline Adebimpe Adewuyi Enjoins Girl-Child". Tropic Reporters. Archived from the original on 2021-11-15. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Roseline Adebimpe Adewuyi from Nigeria is OD Young Person of the Month for November 2021! | Opportunity Desk". 2021-11-05. Retrieved 2025-04-21.
- ↑ "Roseline Adebimpe Adewuyi from Nigeria is OD Young Person of the Month for November 2021!". Ghanayo. 2021-11-05. Archived from the original on 2021-11-15. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "I teach young girls to discard society's scripts and follow their individual purpose —Roseline Adewuyi, social educator and gender advocate". Tribune Online. 2020-10-10. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Breaking gender barriers through education". Africa Renewal. 2024-04-22. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Roseline Adewuyi Publications".
- ↑ "Adewuyi Roseline Adebimpe". scholar.google.com. Retrieved 2025-04-20.