Jump to content

Ronke Doherty

From Wikipedia

Queenie Ronke Doherty (wey dem bon for 1916) na wumen lida for Naija. Shi bi President of National Council of Women’s Societies (NCWS) from 1976 go rich 1980. Shi bi one of di few wumen wey hold big politikal post for Naija during di 1970s.[1]

Tori abaut ha laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ronke Williams for 1916, to Nathaniel Fehintola Williams, wey bi Egba man. Shi go CMS Girls School, den enta Queen’s College, for Lagos for 1930, wia shi finish skul for 1934.[2]

Even though gels for Lagos dat taim no get plenti chans laik bois, one of ha tichas enkorej ha to travul go England to get tichin diploma. Shi go Southlands College and King's College, for London, wia shi stodi and kolet ha tichin satifiket.

Afta shi kom bak to Naija, she stat to tich for CMS Girls School, for Lagos.

For 1940, shi mari Richard Adeeyo Doherty, wey bi loya wey leta bikom Spika of Western House of Assembly.[3]

Shi folo am go Ibadan, and even though shi no get pamanent job dia, shi join plenti volontia grups, laik: Leprosy Relief Association, and Red Cross (Shi leta bikom di oga kpatakpata of di Ibadan branch)

Shi help fait smallpox epidemic for Ibadan and also sopot pipul for Asaba for Nigerian Civil War.

From 1945 go rich 1960, shi: wok for Government Scholarship Board for Lagos, bi seketri for Western Region Scholarship Board, and tich smol taim again for Queen’s College. Shi leta bikom Presido of Western State NCWS

For 1976, shi bikom Presido of National Council of Women’s Societies (NCWS) for all Nigeria.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Udoh, Valentine (1999). The feminization of development processes in Africa : current and future perspectives. James Etim. Westport, Conn.: Praeger. p. 27. ISBN 978-0-313-02496-2. OCLC 654811725.
  2. Osindele, Bisi (June 15, 1969). "Humanitarian with no Regrets". Daily Sketch.
  3. Ojewusi, Sola (1996). Speaking for Nigerian women : (a history of the National Council of Women's Societies, Nigeria). Abuja, Nigeria: All State Pub. and Print. Co. pp. 299–301. ISBN 978-32382-0-5. OCLC 42714200.