Jump to content

Rita Chikwelu

From Wikipedia
Rita Chikwelu
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Country for sportNaija Chenj-am
Fest nemRita Chenj-am
Wen dem bon am6 March 1988 Chenj-am
Ples wey dem bon amAsaba Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej, Igbo langwej Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialitymidfielder Chenj-am
Member of sports teamUmeå IK, FC United, Umeå IK, Nigeria women's national football team, Turun Palloseura Chenj-am
E pipulIgbo langwej Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Eye kolorblack Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number18 Chenj-am
Participant in2008 Summer Olympics, 2016 African Women's Championship, 2018 Africa Women Cup of Nations, 2019 FIFA Women's World Cup Chenj-am

Rita Chikwelu (dey bon am 6 March 1988) na Naija profeshonal futbola wey dey plei front an midfida for Al-Riyadthc, one futbol klub wey de Saudi Wumen Premiha Ligi an for Naija Wumen Nashona Tim. Chikwelu don plei for Umeå IK klub an Kristianstads DFF klub wey de Sweden. E don olso plei for Madrid CFF, an Levante Las Planas. Dis two klub de Spain.[1]

Hau e tek plei futbol for klub

[chenj-am | chenj-am for orijin]

From 2006 go rish 2009, Chikwelu plei futbol for FC United, one klub wey de Finland. Na Chikwelu bi di hi-yest go- skola for di Finish Wumen Ligi ( anoda nem for di ligi na Naisten Liigi) in 2009 as e get 22 go.

Fom 2010 go rish 2016. Chikwelu plei futbol wit Umeå IK. Afta seven yies don pass wey Chikwelu yuz plei wit Umeå IK, e komot liv dem wen di klub go religeshon an join Kristianstad DFF. Di kontrat wey Chikwelu sahin tok sey na two yies e go tek plei futbol wit dem. Chikwelu leta kolet trasfa go Madrid CFF an e stil go Levante Las Planas wey de Spain. For August 2023, Chikwelu sahin for Saudi Klub Al-Shabab.

Hau e tek plei for im kontri

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chikwelu join di Naija fimeli futbol tim wey go FIFA Wold Kup wey hapun in 2004 an 2008. Chikwelu plei im fest futbol game for Naija Fimeli Sinior Nashonal Tim in 2007 wen e join di Fimeli Nashonal Tim go FIFA Wumen Wold Kup. E de di tim wey go 2008 Summer Olympics kompetishon wey hapun in China. Chikwelu stil de di tim wey go 2011 FIFA Wumen Wold Kup.

  1. https://www.espn.com/soccer/player/bio/_/id/108946/rita-chikwelu