Jump to content

Reuben Abati

From Wikipedia
Reuben Abati
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemReuben Chenj-am
Famili nemAbati Chenj-am
Wen dem bon am7 November 1965 Chenj-am
Ples wey dem bon amAbeokuta Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dujournalist, politician, television presenter, columnist Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Calabar Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Eye kolordark brown Chenj-am

Reuben Adeleye Abati (dey bon am 7 November 1965) na Naija jornalis, politishan, TV prisenta, an pesin wey dey rait inside nuiz-pepa. Abati na im PDP (Pipo Demokratik Party) chuz as dia deputi govnor kandidet of Ogun Stet in di 2019 Eleshon. Forma Naija presidor Goodluck Jonathan pik Abati as im Spesha Advaisa for niuz mata (mediha) from 2011 go rish 2015.

Bifor Abati bikom presidet Jonathan Spesha Advaisa, e dey wok as Oga patapata for di nuiz-pepa Guardian. Na for 2011 go rish 2011 e tek bi Oga pata pata for di Nuiz-pepa.

How e tek go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Abati finish from Yunivasiti of Kalaba in 1985. E leta go Yunivasiti of Ibadan go stodi as Yunivasiti Skolar. Abati get Ph.D satifiket in Tihata Akt from Yunivasiti of Ibadan. Di part of Tihati Akt wey e gud inside na Dramatic Literature, Theory and Criticism. Abati go rid Law in Legos State Yunivasiti wey de Legos. E get one trenin satifiket in Jornalis from Kolej of Jornalis Yunivasiti of Maryland, Kolej Park, United Stet.(1996-1997). Abati get a satifiket from Said Bizness Skul, Yunivasiti of Oxford wen e go len manijinet an lidaship in 2015.

How e tek work as jornalis

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Bitwin 2000 go rish 2011, Abati folo priset one TV diskoshon program kol Patito's Gang. Patito's Gang na one program wey profesor Pat Utomi arenj.