Jump to content

Remi Tinubu

From Wikipedia

Oluremi Tinubu (wey dem bon for 21 September 1960) na Naija politishan an di fest ledi of Naija kontri sins 2023, as im bi di wife of Bola Tinubu wey bi Naija presidor. Remi kom from Ogun Stet wey de Naija. Remi don bi fest ledi of Legos Stet, e na bifor bifor sineto wey don repiset Legos Sentra Senatorial District for Nashona Hasembli. Remi na member of All Progressives Congress (APC) politika parti.

How im tek start life

[chenj-am]

Dem bon Remi Tinubu on 21 September 1960. Remi paret bon 13 pikin an Remi bi di nomba 12 inside di 13 pikin wey Dem bon. Remi famili kom from di Ikusebiala famili of Ogun Stet.

How im tek go skul

[chenj-am]

Remi go Our Lady of Apostles sekondiri skul wey de Ijebu-Ode an na di skul im tek rait im WAEC in 1979. Remi leta do PGD from di Redeemed Christian Bible Kolej in 2010. Remi rid edukeshon from di Yunivasiti of Ife. E stil get Nashonal Satifiket of Edukeshon in Botany an Zoology from di Adeyemi Kolej of Edukeshon.

How im tek put bodi for politis mata

[chenj-am]

Remi bikom di fest ledi of Legos Stet wen im mari Bola Tinubu wen Bola Tinubu stil bi do gofnor of Legos Stet dat time. Wen Remi stil di fest ledi, e start one organaseshon wey im kol The New Era Foundation. Di koko of di fondashon na to enkoreji youth to bi beta pipo an helep di pipo of Legos to no di impotat of mek envaromet dey de klin an mek dem sabi te-kia of di health. Wen Remi win di eleshon as Sinetor, smol wahala fest de di Legislative House Election Petition Tribunal. Leta, di tribunal kom leta kom togeda an hagri sey e win di eleshon in 2012.