Jump to content

Razak Okoya

From Wikipedia
Razak Okoya
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am12 January 1940 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Wok wey e dey dubusinessperson Chenj-am

Razak Akanni Okoya (dey bon am 12 January 1940) na Naija bizness man wey get plenti moni. E stil get one tahitu wey bi: Aare of Legos. Okoya bi di fonda an di Oga patapata of Eleganza group of Kompini. Eleganza kompini get levu for eni market wey dey westa Afrika.

How e tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Okoya into di famili of Tiamiyu Ayinde Okoya wey de live for Lagos. Okoya na Yoruba pesin. Okoya go Ansar-Un-Deen pamari skul wey de Oke Popo. Na onli pamari skul Okoya go. Okoya dey always helep im papa for shop. E papa na tailor an e dey sel matiriha for klot.

Wen Okoya don get sense wel wel from di telorin bizness, e komot go form im own bizness.

At dat time, Okoya save 20 pound an e mama give am 50 pound to yuz am do bizness. Na so Okoya start to dey buy guds from Japan kom Naija.

How e tek put bodi for bizness

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okoya travul go meni ples to len how oda kontri-dem dey mek tins bikos e biliv sey Naija tu go fit do wetin oda kontri dey do.

Okoya fest wife, Kuburat Okoya like to dey buy shain an shin-shin tins wey kos wel wel for fashon an dis one dey always mek im hosband vex. Dis one mek Okoya travul go forin kontri to go buy di mashin wey dey do shain kom Naija. Na so Okoya tek enta shain bizness. Leta, Okoya join slipas, foot-wear an bag to wetin e kompini dey mek for Naija. Eleganza group of kompini join pots, electrik fan, an biro to tins wey dey komot from dia kompini. Eleganza group of kompini de Oregun-Ikeja, Isolo, Alaba, an Iganmu. Di kompini get ova five thousand wokas wey e dey pay evri month. Eleganza group of kompini na one of di kompini wey big pass in Naija as di kompini get six fatiri an meni Naija pipo sabi di kompini wel wel.

E pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okoya get plenti wife an e bon plenti pikin-dem. One of e pikin, Moji Tejuosho mari Omoba Lanre Tejuosho. Omoba Lanre Tejuosho na pikin of a king. Kuburat Olayinka Okoya, wey bi Okoya fest wife don de with Okoya for ova 50 years.

Di nem of Okoya oda wife-dem na:

  • Ajoke Okoya
  • Jennifer Okoya
  • Zainab Okoya, an
  • Shade Okoya

Shade Okoya wey bi di niu wife of Okoya dey kontro Eleganza group of Kompini. Shade Okoya bon 4 pikin-dem for Okoya an dia nem na:

  • Olamide
  • Subomi
  • Oyinlola
  • Wahab