Jump to content

Rauf Aregbesola

From Wikipedia

Rauf Adesoji Aregbesola (dem bon am 25 May 1957) na Naija politishan wey don sarf as minista of di interior of Naijiria from 2019 go rish 2023. E don bi gofnor of Osun Stet from 2010 go rish 2018.

How im tek Start life an go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Aregbesola na muslim pesin but na for famili of both muslim an Kristen e tek kom from. E do e pamari an sekondiri edukeshon for Ondo Stet. Aregbesola go The Politeknik Ibadan. For di Politeknik, e rid Mekanika Enjinerin Teknoloji. Na for 1980 Aregbesola finish im Politeknik edukeshon.

Meni pipo dey komplain about Aregbesola Politeknik edukeshon sey e no too klair. The Politeknik Ibadan dey onli give Nashonal Diploma an Hi-ya Nashonal Diploma in Mekanika Enjinerin Teknoloji. Dis one mins sey pesin wey finish for di skul go online bi Enjinerin Teknolojist onli. Dis tin na wetin COREN Enjinerin Cadres in Nigeria tok bi dat.

How im tek put bodi for politis

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Aregbesola start to dey put bodi for politis wen e stil de politeknik as im bi spika of di studet parlimet (1977-1978). Aregbesola leta bikom Presidor of di Black Nationalist Movement (1978-1980). E sopot meni studet movumet wey de di kontri an dis one mek dem give am a life memba inside di National Association of Technological Students. In June 1990, Aregbesola bikom di deligate to di Sosha Demokratik Parti wen dem start Lokal Govamet Aria Kongress. For July of di sem year, Aregbesola de among di deligate to di fest Nashonal Konvenshon wey hapun in Abuja. Aregbesola do e pat to mek suo sey militiri govamet lif Naija govamet in di 1990s.

Wen Naija riton to demokrasi in 1999, Aregbesola dey among di pipo wey de Alliance for Democracy. For di Alliance for Democracy (AD) parti, na Bola Tinubu bi dia lida wey dey kontro di parti. Bola Tinubu leta bikom di Gofnor of Legos Stet. Na Aregbesola bi di Dareto of Bola Ahmed Tinubu Campaign Organization (BATCO). Dis one mek Tinubu win di eleshon to bikom di gofnor of Legos Stet. Aregbesola yuz di Independent Campaign Group helep Tinubu to enta as gofnor for di sekod time.