Jump to content

Raquel Barros

From Wikipedia

Raquel Barros Aldunate (dey bon am December 2, 1919 an e kpai in August 11, 2014) na Chile wuman wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Pipul sabi Barros wel wel bikos of e risach wey e du on Chile tradishonal song an dans.

How e tek stat life an go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 1952 Raquel Barros form di Folklore Association of Chile. E bi di daretor of dat grup for meni years. Di nem to di grup don chenj to "Raquel Barros Folklore Group of Chile" an na di grup old pass for Chile kontri as far as tins abaut kolsho is konsain. Barros na risasha at di Yunivasiti of Chile at di Institute of Muzikal Risach an for dia Muzikal Dipatmet bitwin 1958 go rish 1980. Barros don wok as Vais-dean an hasitat dean for di Falkoti of Muzikal Sayens an Akts an Paformans from 1974 go rish 1975. In 1973, dey mek Barros di daretor of di Nashonal Folkloric Ballet. As Barros dey du e risach, e dey always join an rekod how pipul dey du tins for old way. Even wen Barros don old, e stil dey rait an tok abaut Chile kolsho. Wen e na 82 years, dey mek Barros di presidor of di kolshora senta of di Municipality of Recoleta.

In 1996, dey mek Barros one of di honorabu memba of di pamanet Intanashonal Folklore Kommishon wey dia hed-ofis dey Beunos Aires in Argentina. In 2004, Barros join as memba of di "FONDART" projet kwulifikashon Kommishon of di Nashonal Kansu of Kolsho an di Akts.

Raquel Barros fall wen e dey house an tek Kari go hispitu. Barros kpai at di Hospital del Salvador in Santiago on August 11, 2014.

Buks wey e don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Some of Barros buks wey e don poblish bi:

  • "El folklore de Chiloé", wey Nashonal Seketri of Wumen for di OAS mitin, Santiago poblish in 1979. ( Manuel Dannemann join hand du di buk)
  • "La poesía folklórica de Melipilla", Revista Musical Chilena, No. 60, Santiago, 1958
  • "La danza folklórica chilena – Investigación y enseñanza", Revista Musical Chilena, No. 71, Santiago, 1960
  • "El guitarrón en el Depto. de Puente Alto", Revista Musical Chilena, No. 74, Santiago, 1960
  • "Introducción al estudio de la tonada", Revista Musical Chilena, No. 109, Santiago, 1964
  • Guía metodológica para el estudio del folklore chileno, Editorial Universitaria, Santiago, 1964
  • La ruta de la Virgen de Palo Colorado, Santiago, 1966
  • El romancero chileno, Santiago, 1970

Apart from di buks-dem wey Barros rait an poblish, e stil arenj list of tradishonal muzik wey de rekod in di Tradishonal Muzik Rekod of di Falkoti of Akts of di Yunivasiti of Chile.