Jump to content

Rafiah Idowu Sanni

From Wikipedia

Rafiah Idowu Sanni na Naija wuman wey sabi tich pipul, sabi Islamic rilijon wel wel, and shi dey lid for komuniti. Shi bi di Amirah (na oga presido) of Federation of Muslim Women Associations for Nigeria (wey piul dey kol FOMWAN). Na faith grup wey dey help Muslim wumen get pawa and fait for dia raits, and shi don dey lid dem sins 2021.[1]

Shi don du plenti wok to help komuniti grow and to push Muslim wumen mek dem get beta laif, insaid Islamic way. Dem pik Alhaja Rafiah as di 10th National Amirah for FOMWAN, for di 36th Annual National Conference wey hapun for August 2021.[2]

Hau tek stat laif and go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Alhaja Rafiah kom dis laif 11 for November 1960, for one place wey dem dey kol Ikare, for Naija. Shi du ha smol pikin skul for Naija. Afta dat, shi go haya skul, wie shi get Upper Credit for Metallurgy (na wok wey get to du wit metal) from Kwara State College of Technology. Shi stil go du Post-graduate Diploma for Education, and shi get difrent satifikets from skul for America and Saudi Arabia.[3]

Work wey shi don du

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Alhaja Rafiah don dey pat of Federation of Muslim Women’s Associations of Nigeria (FOMWAN) sins dem stat am for 1985. Shi folo stat di grup and shi bi one of the fest pipul wey join am. For 36 yias wey shi don dey wok wit FOMWAN, shi don hold plenti big big posishon laik: National Da’wah Officer (na pesin wey dey tich abaut Islam), National Public Relations Officer (na person wey dey tok for di grup), and Chairperson for Da’wah and Advocacy (na pesin wey dey oganaiz Islamic tichin and fait for beta tin).

For 2021, dem elekt ha as di 10th National Amirah of FOMWAN. Sins dat taim, shi don represent di grup for difrent big mitin for Naija and for kontris laik Saudi Arabia, Uganda, Kenya, and Tanzania.[4]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. tolu, micheal (2021-10-10). "Oyo Produces New National Amirah Of FOMWAN". Inside oyo. Retrieved 2025-04-27.
  2. tolu, micheal (2021-10-04). "FOMWAN Tells Nigerian Women to stand up to their responsibilities". TVC News. Retrieved 2025-04-27.
  3. saheed, salawu (2021-11-04). "FOMWAN salutes Sultan". tribuneonline.net. Retrieved 2025-04-27.
  4. tolu, micheal. "Muslims, architect of their own media under-reportage – FOMWAN National Amirah". Muslim News. Retrieved 2025-04-27.