Jump to content

Pura Belpré

From Wikipedia

Pura Teresa Belpré y Nogueras ( dey bon am 2 February 1899 an e kpai 1 July 1982) na one wuman wey kom from Puerto Rico. Belpré bi di fest Puerto Rican pesin to work in New York librari. Belpré na raita, pesin wey dey gada tradishonal tori and song, an pesin wey fit yuz bebi mek pipul laff an do fims.

How e tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Cidra, Puerto Rico dey bon Belpré. Pipo no rili no di day wey dem bon Belpré. Some pipo sey na 2 February 1899, oda pipo sey na 2 December 1901, anoda pipo sey na lai sey na 2 February 1903. Belpré finish from Sentra High skul wey de Santurce, Puerto Rico in 1919. E kom enta Yunivasiti of Puerto Rico, wey de Río Piedras. Belpré rili like to bikom tisha for dat Yunivasiti one day. For 1920, Belpré komot from Yunivasiti of Puerto Rico go New York bikos e wan go see im sista Elisa marej. Wen e rish New York, Pipo wey dem find young young gel wey kom from difren difren plesiss find work for Belpré inside librari.

Dis work wey Belpré si for librari mek am dey traful from siti to siti like from Bronx to lowa East Side. As Belpré dey traful, e dey tok tori yuzin English or Spanish Langwej an dis kind tin neva hapun bifor. Dis tin wey Belpré dey do kom mek pipo wey dey spik onli Spanish si sey dia tori too fit enta librari no bi onli English langwej. Till Belpré finali kpai, e yuz all e live stay New York. If Belpré komot from New York, e no plenti at all. .



How im tek work

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Belpré start to kol Puerto Rico pipo-dem to kom an en-join librari. Belpré life risembu oda Puerto Rico wuman-dem wey fest kom New York in di 20th senturi bikos na kompini wey dey do klot e fest work for. Bikos Belpré sabi spik Spanish langwej, e kom from komuniti wey bi spanish, an e go skul, dis one mek Belpré get posishon as a Spanish Hasistas for one bransh of di poblik librari wey de 135th Strit in Harlem.

Dis one hapun afta Ernestine Rose don tish am how to do di work. Ernestine Rose bi di head of Harlem librari. Belpré kom bikom di fest Puerto Rican. Dis one hapun bikos of Ernestine Rose wey haya an tish am di work. Ernestine Rose bi di oga pata of Harlem Iibrari. Belpré kom leta bikom di fest Puerto Rican pesin wey New York Public Library fest haya.

For 1925, Belpré start to dey stodi in Library School of the New York Public Library.