Princess Wanda
Prinses Wanda (tori tok sey e live in 8 senturi for Poland) na gel-pikin of di Lechitic King Kratus. Na king Kratus bi di fonda of Kraków. Wen prinses Wanda papa kpai, e bikom di king of Poland but keta kill imsef bikos e no wan mari.
Im tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di fest raitin rekod wey de about Wanda na wetin polish tori raita Wincenty Kadlubek. Meni pipo wey sabi hodin dayz tori bilif sey na lie Wincenty Kadlubek dek tok for wetin e rait. In Kadlubek tori, e tok sey wen e papa kpai, prinses Wanda bikom king an kontro di pipo of Poland. E tok sey dat time, di pipo of Alamann tyrant dey fight Poland. E tok sey prinses Wanda dey always dey folo join im solja to go fight dem. E tok sey wen di solja of German see sey prinses Wanda fine wel wel, dey no dey fight am again an sey di lida of German solja yuz im hand kpai imsef. Akordin to di tori, Prinses Wanda tok sey mek dem nem one riva Vandalus afta am. Dey kol dey kol pipo wey prinses Wanda dey kontro Vandals. For Kadlubek tori, prinses Wanda no mari an e live long wel wel.
Difren vashon of di tori na im de. For di vashon wey For di vashon of Wielkopolska Chronicle, di Alemannic lida, Rytygier (Rüdiger), fest wan mari Wanda. Rüdiger vex go fight Wanda land bikos Wanda no gree to mari am. Na inside dis fight Rüdiger kpai. Na inside dis sem fight too Wanda sakifaise im life to di gods sey bikos dem helep win Rüdiger.
For anoda tori, Wanda go kpai imsef inside Vistula riva bikos Wanda no sey if e no kpai, meni men go wan fight im pipo dem go wan mari am an e no go gree mari dem. Na Jan Dlugosz wey dey live dorin di 15 senturi mek dis vashon popular wel wel.
How im life tek hafet dia kolsho
[chenj-am | chenj-am for orijin]Pipo bilif sey na Wanda Mould dem beri Prinses Wanda. Pipo dey on light on Mound on Pentecost sins bifor dem stop am in di 19 senturi. In 1949, di bizness aria wey nie Mould on Pentecost start to dey arrenj one konstrushon on di nem an day of Wanda (23 June). Bikos of dis, pipo wey de di aria pipo see Prinses Wanda as one of di impotat tins for di aria. Di aria konten a bizness senta, strit, bridge, an big stediom wey dem nem Wanda. Di German raita Zacharias Werner rait one drama wey e nem Wanda. Werner frend Goethe akt dis drama on stej in 1809.
Di tori if Wanda popular wel wel for Portugal akt, kolshor, an buks. For ezampul, di Portugal raita C.K Norwid go see Mould in 1840 an rait a epik tori about Wanda to fit honor am.