Princess Olufemi-Kayode
Princess Olufemi-Kayode (wey pipul stil dey kol Modupe Olufemi-Kayode)[1] na wuman from Naija wey sabi how dem dey stodi pipul wey do bad tin and shi dey fait wel wel mek dem trit pikin dem wel. For 2007, shi join one big grup wey dem dey kol Ashoka Fellowship (na grup wey dey kari beta pipul wey wan chenj wold). Shi bi oga for one grup wey no dey du bizness to mek moni wey dem dey kol Media Concern for Women and Children Initiative (MEDIACON). Dis grup na one wey United Nations Development Programme (UNDP) don put for list as beta grup. Dem dey help pikin dem wey bad pipul don do bad tin to, laik toch dem for bodi wey no gud or yuz dem enihau.
Hau shi tek stat laif and go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen Princess stil bi smol pikin, bad pipul wey shi sabi abuse ha plenti taims. Shi sofa wel wel. For 1979, shi rait two smol poem abaut di sofa wey shi pas tru.[2]
Work wey shi don du
[chenj-am | chenj-am for orijin]Princess don wok for one big paper wey piul dey rid (dem dey kol am Punch newspaper). For insaide di paper, shi get ha own place wey she dey rait ha tok evri taim, dem kol am "Princess Column". Shi dey waka go difrent places for Naija and for abroad to go tok for mitin. Shi laik pikin dem pas enitin.
For yia 2000, shi opun one grup wey dey help wumen and pikin dem, di nem of di grup na Media Concern for Women and Children. Di wok of di grup na to stop bad bad tin wey pipul dey do to wumen and pikin (laik sexual wahala) and to help pipul wey don olredi sofa di bad tin, both for Naija and Africa.[3] Shi don show for plenti tok show for radio and TV program wia shi dey yan ha espiriens.
Shi join Ashoka Fellowship again for 2007.[4]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Olisa, Blessing. "Why sexual abuse is rampant". The Nation. Retrieved 27 April 2025.
- ↑ Adeboye, Olukemi. "I attempted suicide in my teenage years". The Point. Retrieved 27 April 2025.
- ↑ "Teenagers' unwanted pregnancy nightmare". The Nation. Retrieved 27 April 2025.
- ↑ "Princess Olufemi-Kayode". Ashoka Fellow. Retrieved 27 April 2025.