Papa Legba
Papa Legba na spirit in west Afrika Vodun an dia envaromet. (Dominican Riplobik dey kol Vudú, Haitian pipo dey kol am Vodou, Louisiana dey kol am Voodoo an Winti). Papa Legba na spirit wey dey konet human-bein to God. Na Legba papa dey ditamin weyda pesin fit spik to spirit of Guineé or dem no go hagri mek e do am. Legba papa fit spik all di langwej wey human-bein dey spik. Inside di tradishonal tori wey pipo of Haiti dey tok, Haiti pipo bilif sey Legba papa sabi give poblik tok wel wel. Dem sabi helep pesin to fit komuniket an onda-stand poblik tok. Wen pipo dey tink of Legba papa dey dem always konet dem with dog. Bifor eni serimoni go start, dem dey ask for di blessin of Legba Papa. Na for Westa Afrika kindom Dahomey (todey dia nem na Benin) di bilif an orijin of Papa Legba tek start.
How dem luk like
[chenj-am | chenj-am for orijin]Legba papa dey luk like old man wey dey waka with stick or kane. Dem stil dey put on kap an dey smoke siga or drink ogogoro. Legba papa like dog wel wel an dem dey holi to dem.
Di tori of Legba Papa wan risembu di tori of Saint Peter, Saint Anthony, an Saint Lazarus.