Oyin Oladejo
Oyin Oladejo (na 1985 dem bon ha for Ibadan, Nigeria)na Naija-born Canadian aktres, na di pat shi akt as Joann Owosekun for one televishun series Star Trek: Discovery, make ha popula.
Ha laif tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Olajide for Ibadan, Nigeria. Shi gro up for Lagos. Shi mov to Canada for 2001 wen shi bi 16yies. Ha mén plan na to studi law, but shi reject am. Na wen shi stat to sell ticket for wan Canadian Opera Company, ha maind com enta akting. Shi komplit wan theatre arts course for Humber College Toronto, an di Soul Pepper Academy for Toronto. Shi stat to do small small theater wok for Toronto, shi stil do supporting rol for wan short fim, but shi no get any beta fim kontract. For one intaview, shi sey shi bin wan giv up akting wok. Last last shi tek advice of ha égent mek shi do vidio for casting part wé shi no sabi di fim. na afta shi do di kastin na im shi get rol to akt bridge officer Joann Owosekun for Star Trek: Discovery. Oladejo don akt for oda pat of di fim since di fes pat. For di followin yies, Oladejo don akt as Ophelia for William Shakespeare's Hamlet an for di man rol of Lopakhin for Anton Chekhov's The Cherry Orchard