Jump to content

Oya

From Wikipedia

Ọya (for Yoruba, dem dey kol am Ọya, Oyá, or Oiá; Yàńsàn-án or Yansã; and for Latin America, dem dey kol am Iansá, Iansã, or Iansan) na one kain Orisha wey dey kontrol breeze, thunder, an heavy storm. As wota spirit, dem stil sabi Ọya as spirit wey fit bless pipu wey wan pikin, or pipu wey go her river bank for Niger River.

Belief about Ọya

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ọya bin liv for dis wod as human being. Shi kom fom one town wey dem dey kol Ira, wey dey Kwara State for Nigeria dis taime. Shi mari Alaafin of Oyo, Shango. For Yoruba, dem say her nem "Ọya" kom fom “ọ ya,” wey mean “shi tear,” bikos dem sabi her with strong breeze and wind. Ọya get power to turn hersef to buffalo, an for Yoruba poetry, dem dey holways tok abaut this buffalo mata. Bikos of dis, buffalo na one of Ọya big saign, an e dey rong for her priests to kil buffalo. Ọya dey also kol Ọya Ìyáńsàn-án, wey mean “Mama of Nine,” bikos shi bon nine pikin wit her third husband, Oko, afta shi don suffer for pikin for long. Ọya dey guide Niger River wey Yoruba pipu sabi as Odò-Ọya. For Yoruba religion, Ọya mari three times. First, shi mari Ogun (warrior Orisha), afta Shango, an leta, shi mari hunter an farma deity, Oko. Ọya worship no dey evriwhere for Yoruba land bifor. Na only pipu wey di Oyo Empire dey control dey worship her. But bikos of Atlantic slave trade, meni pipu wey dey worship Ọya fom Oyo said dey kari am go New World (America), and her worship come spread for plenti plez. Nau, Ọya worship don stil spread for oda Yoruba areas.

Ọya for Candomblé

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For Candomblé (Afro-Brazilian religion), dem sabi Ọya as Oiá, lyá Mésàn, or most taimes pipu dey kol her Iansã (fom Yoruba wod Yánsán). Lik hau Yoruba pipu sabi Ọya, for Candomblé, Iansã dey kontro wind, thunderstorm, an lightning. Shi be queen of Niger River and na strong warrior wey nobodi fit win. Dem dey talk say Iansã get strong emotion, charm, and pawa. Shi stil get the pawa to kontro dead people matter and the mystery wey surround death. For Candomblé tradition, dem dey kompare Iansã to Saint Barbara, and for Angola Congo grup, red na her color.

Ọya ritual food

[chenj-am | chenj-am for orijin]

One food wey dem dey uze for Ọya na Acaraje. Acarajé na round akara wey dem mek wit peeled an crushed black-eyed beans, and dem dey put small smol shrimp, okra, crush groundnut, an hot pepper for inside. Dem go fry am for red palm oil (dendê oil). Na traditional Afro-Brazilian fud and na Ọya offering for Candomblé tradition. Dem dey also do plain version of this akara for Ọya rituals, but the one wey get pepper and seasoning, dem dey sell am for street for Bahia, Brazil. Other foods wey dem dey use for Ọya na Ipete an Bobo de Inhame (yam porridge). For Yoruba saide, Ọya fud na Àkàrà. Eggplant, mulberries, pudding, an dark chocolate stil dey konnet to Ọya.

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]