Jump to content

Our Husband Has Gone Mad Again

From Wikipedia

Our Husband Has Gone Mad Again na play wey Ola Rotimi (im full name na Olawale Gladstone Emmanuel Rotimi) write. Di play center around one former military Major wey dem dey call Lejoka-Brown, wey enter politics for modern-day Africa.[1][2]

Di play follow story of one former military major wey dem dey call Lekoja-Brown, wey enter politics for modern-day Africa. Lekoja-Brown dey struggle for di political world and e no really understand wetyn dey happen for there, and na pride dey majorly push am instead of real love for im country. All these struggles come dey cause plenty things wey funny wey di writer write for the story.

Wahala come increase when im American wife come back and discover say e don marry two oda wives when she no dey around. As Lekoja-Brown dey try handle both im political problems and family issues, di story dey show plenty real problems wey dey for politics, like ambition, opportunism, and how politics fit sometimes look ridiculous.[3]

Before di play start, di Major don marry one woman wey be Kenyan wey dem dey call Liza. She study medicine for US. Liza con come Nigeria come stay with am, but she no know say e don already marry two oda wives.

Di first wife na older woman, wey be im late brother wife before, and e marry am based on Muslim custom. Di second wife young well-well, and na political strategy make e marry am. Wen Liza come arrive and discover di other wives, things come turn upside down. Instead of fighting, Liza join body with di other wives. She teach di older one about supply and demand, and encourage di younger one to stand against di Major for election.[1][2]

  • Rahman Taslim Lejoka-Brown na di main character and na retired army officer. E be comic person for di play and e represent politicians for Nigeria wey be “new” but still dey behave like old ones. E enter politics and marry Sikira so e go gain people come him side.
  • Liza na trained medical doctor for US, wey marry Lejoka for Congo. When she come back after her studies and see di polygamous marriage, she no gree accept am and begin cause serious tension before she later leave di marriage.
  • Mama Rashida na Lejoka first and main wife, wey e inherit from im late elder brother. She represent submissive woman wey always agree with her husband.
  • Musa Osagie na member of di national party wey help Lejoka win election.
  • Polycarp na loyal but illiterate house help for Lejoka house.
  • Sikira na young and friendly daughter of Madam Ajamku, leader of di market women union, and also Lejoka second wife. She later become candidate for opposition party against am.
  • Alhaji Mustafa na Lejoka neighbor, na quiet man but good person. Dem later demolish im house.
  1. 1 2 https://www.amazon.com/Our-Husband-Has-Gone-Again/dp/9781540036
  2. 1 2 https://leadership.ng/proposed-federal-govt-ban-has-our-husband-gone-mad-again/
  3. https://www.africanbookscollective.com/books/our-husband-has-gone-mad-again