Oshun
Oshun na one god in yoruba land wey pipo bilif sey e dey give love, e fit mek wuman get belle. Pipo stil see Oshun as god wey get koneshon with beuti, wota, sex, an moni. With ova 401 gods wey de, na Oshun pipo no pass an na still Oshun pipo dey woship pass. Inside Yoruba tradishonal tori-dem, Oshun na kween to king Shango of Oyo. Na afta Oshun kpai pipo kom start to dey woship am. Na one festiva wey dey hapun evri August at Osun- Osogbo Sacred Grove dem yuz dey woship Oshun. Dis festiva dey tek two-wik. Na violin instrumet pipo dey play for di Oshun Festiva an some Oyinbo muzik an Cuba popula song.
Di tori from tradishonal tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen lfa Literacy Corpus dey tok di tori of Oshun, dem sey Oshun na di onli fimeli spirit wuman wey Olodumare wey bi Baba God sent to king Shango to helep am fit kreate dis wold. Di oda spirit wey Olodumare (God) send no wan work with Oshun an dis one mek Oshun go mit Shango for advais an hasista. Anoda vashon of di tori tok sey all di oda fimeli spirit wuman wey Olodumare (God) send kom di wold wan do dia tins on dia own without man. Bikos of dis one, all di oda fimeli spirit wuman no fit kreate di wold. Anoda vashon of di tori tok sey di spirit-dem wey bi man too no wan join hand with fimeli spirit to kreate di wold. Dis bi-a-viho mek dem no fit kreate di wold. No mata di vashon of di tori wey hapun, di tori end wen Shango dimand sey mek oda spirit wey bi man respet Oshun. Shango evun tok sey mek dem dey give Oshun di sem respet wey dem dey give am.
When Oshun kpai, Olodumare give am pawa mek Oshun sef fit bi orisha.
How pipo dey woship am
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Yoruba
Na Oshun bi di goddess wey dey kontro Osun Riva wey de Naija. Di Osun Riva get im orijin in Ekiti Stet . Ekiti Stet de di westa part of Naija. Di Riva flow pass di siti of Osogbo. Na for Osogbo di Osun-Osogbo Sacred Grove de, an na dia bi di main aria wey pipo dey yuz to woship Oshun. Na two-wik e dey tek pipo to woship Oshun evri year. Di festival dey always hapun evri August at di Osun-Osogbo Sacred Grove nia di Riva side of di Riva.