Omoyele Sowore

From Wikipedia
Omoyele Sowore
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am16 February 1971 Chenj-am
Ples wey dem bon amOndo State Chenj-am
Pesin wey e mariOpeyemi Sowore Chenj-am
Wu e dey wok forAfrican Action Congress, Sahara Reporters Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, School of International and Public Affairs, Columbia University Chenj-am
Candidacy in election2019 Nigerian presidential election Chenj-am
Located in protected areaAbia State Chenj-am
Official websitehttp://saharareporters.com/ Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Omoleye "Yele" Sowore (dem bon am for February 16, 1971) na Naija pesin wey dey fight for human mata, an pesin wey dey kampain for Demokrasi govamet in Naija.Na Omoleye Sowore bi di founda of Sahara Reporters wey bi online Niuz Agensi.For August 2018, e fom di African Action Congress parti an e bi di kandidet of di parti for di parti chuz to go bi di presidor of Naija in di 2019 jeneral eleshon. Di Nigerian State Security Service harest Sowore on August 3, 2019 bikos dey tok sey e dey fight govamet bifor of di ralli wey e du. Di nem of di ralli na "RevolutionNow". Dey stil harest an flog Sowore dorin one protest in Abuja on January 1, 2021. Sowore stil sofa injuri dorin a protest in Abuja on May 31, 2021.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na from Ese-Odo, Ondo Stet Yele Sowore.Na for Naijá Delta rijion dey tek bon Sowore ( Naijá Delta get six Stet an som of dem na Ondo Stet, Abia Stet an Imo Stet.Wen Sowore dey 12 years, e dey yuz okada evri morin go riva go dey kach fish so dat e famili go fit chop.Na bikos of how militari govamet dey tek yuz dia pawa mek Sowore tok sey e sef go dey wok for niuz if e gro. Sowore go rid Jiografi an Planin for University of Lagos from 1989 go rish 1995. E no finish yunivasiti on time bikos dey tok sey mek e go stay for house for two years bikos of e politikal risin an student hativitis.Sowore bi di presidor of Yunivasiti of Lagos Studet Yunior bitwin 1992 go rish 1994.Wen e bi presidor of Studet Yunior, e tok against kortis an korupshion.Sowore get Masta digri for Poblik Hadministrashon from Kolombiha Yunivasiti.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1989, Sowore tek pat in "we no go gree" wey studet du bikos of di kondishon wey IMF (International Monetary Fund) tok sey Naija go du bifor dey boro dem $120 million wey dey wan tek du orye pahip line.Di kondishon bi sey dey go ridus nomba of Naija yunivasiti from 28 to 5 yunivasiti. Na Sowore bi di lida wey kari 5,100 studet du di "we no go gree" rahiot in 1992.Na Seven studet police kpai for di rahiot.Police harest Sowore an beat am.Sowore still dey among di pipul wey fight sey we no wan militiri govamet, sey mek Demokrasi govamet dey Naija on June 12, 1993.For harest Sowore meni times by govamet pipul.

E harest[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di DSS harest Sowore on August 3, 2019 bikos of sey e dey plan one "we no go gree" protest lol #RevolutionNow protest.Meni popula pipul kondem di harest. Pipul like Wole Soyinka, Oby Ezekwesili an odas.Dey hakuss Sowore sey e dey fight against Govamet an e dey yap or insolt Presidet Muhammadu Bihari. Fediral Govamet give Sowore bail on September 24, 2019 on di kondishon sey e go rilis e intanashional passport witdin 48 hours. Wen Sowore wan tok to Niuz pipul on September 29, 2019, e tok abaut di kind sofa sofa wey e si for prisin.E tok sey dey gree mek Boko Haram ogas dey yuz telifone an TV for prisin bot e no fit yuz did tins.Di kot kom tok sey mek Sowore dey go home on December 5, 2019 afta wey e don setu e bail.DSS stil kom harest am di sem day again. E finali mek am go home on December 24, 2019. For December 2021, di Hi Kot for Abuja tok sey mek DSS (Department of State Service) to pay 2 million Naira give Sowore bikos of e fone wey dey kolet for e hand wen de harest am in 2019.

Sahara Riportas[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sowore stat Sahara Riportas in New York City in 2006.E tok sey e fom Sahara Riportas bikos e wan tek am fight korupshon an bad govamet pratis. Sahara Riportas no dey kolet moni from Naija Govamet bot na Ford Foundashon an Omidyar Foundashon.

Presidenshal Kampain[chenj-am | chenj-am for orijin]

For February 2018, Sowore mek pipul no sey e wan go for presidet of Naija in di 2019 Nigerian general election.Sowore fom a politikal parti kol African Action Congress, (AAC).Na dis AAC parti e wan tek kolet tiket as Naija Presidor in 2019.Wen di parti du dia pamari eleshon, na onli Sowore kom out as kandidet for presidet on October 6, 2018. Afta wen Sowore don go mit meni big pipul for Naija like Emir of Kano an Wole Soyinka, E stat to dey waka all around di wold lukin for moni.Sowore go Australia, United State of America an UK.Sowore dey Luton, London on 10 November2018.

Eleshon risot[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Sowore kari nomba 5 posishon wit 33,953 wen di risot of di eleshon kom out.Muhammadu Buhari of APC win di eleshon wit 15,191,847 votes an na Atiku Abubakar of PDP kari sekod wit 11,264,977 votes. Sowore pass Fela Durotoye of Alliance for New Nigeria wey get 16,779 votes an Kingsley Moghalu of di Young Democratic Party (YPP) wey get 21,886 votes

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sowore an e famili dey live for Haworth, New Jersey. For September 2021, dey tok sey Sowore junior broda kpai wen kidnapas shot am for Edo Stet.