Omotayo Oduntan
Omotayo Aramide Oduntan (wey dem bon for 5 June 1957) na Naija politishan wey dey spik for Alimosho II eria for di Lagos State Haus of Asembli onda di parti side of di All Progressives Congress.[1]
Life and wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon am for Lagos State for Southwest Nigeria, and na di shi do ha pramari and sekondri skul finish. Shi get smol skul paper for hau to kip fud klin and hau to kari fud wel from di Royal Institute of Public Health. Shi wok bifor as Senior Special Assistant (big helpa) to di Govnor of Lagos State for tins wey konsan pipul for ground level, and shi stil bi memba of Lagos State Haus of Asembli from 1999 to 2003 and again from 2011 to 2015.[2] Shi dey sav nau as Chif Whip (pesin wey dey mek membas folow rule) for di 8th Assembly of di Lagos State Haus of Asembli.[3]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Joshual, Prince (May 5, 2016). "Lagos lawmaker supports Senate on capital punishment for kidnappers". Champion Newspaper. Archived from the original on April 4, 2017. Retrieved April 4, 2017.
- ↑ "Lagos Assembly probes monarch – The Nation Nigeria". The Nation. February 12, 2014. Retrieved April 4, 2017.
- ↑ "Woman of the Sun: politics taught me patience, perseverance –Oduntan, Lagos deputy chief whip – The Sun News". The Sun. June 21, 2016. Retrieved April 4, 2017.