Jump to content

Olga de Alaketu

From Wikipedia

Olga de Alaketu, wey pipu stil sabi as Mother Olga (1925 – 29 September, 2005), na one big Candomblé high priestess. Shi wok wel to mek sure sey Candomblé (one Afrika religion wey travu go Brazil) no mix with Catholicism.

How shi tek stat life and her wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iya Olga de Alaketu na for Salvador de Bahia shi bon in 1925. Shi bi pikin wey come fom one royal famili wey dem kol Aro for Ketu, wey dey for West Africa.

Wen shi bi just 24 years old, dem mek am di head of Alaketu Candomblé community. Di plez na one of di oldest Candomblé hauz for Salvador de Bahia. Shi bi gud leader wey sabi wel, an wey pipu lov an respect til shi waka go meet ha ancestors. Iya Olga no just follow Yoruba tradishon, shi mek sure say di kolsho an customs stil dey. Shi stil join bodi for Brazilian society.

Famili, how shi stat life, an wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Iya Olga na descendant of one Ketu princess wey dem kidnap an kari go Bahia around 1636 to late 1700s. For Brazil, dem mek am the leader of one big Candomblé temple wey dem call Ile Maroia Laji for Salvador da Bahia. Dis temple na one of the oldest for Brazil, and e don see meni important pipu lik writer Jorge Amado an one French anthropologist. Wen govmet declare Ile Maroia Laji temple as nashonal heritage site, Cultural Minista Gilberto Gil tok sey, "For the past 40 years, we fit kol Mother Olga di biggest leader of Orisha religion for Brazil."

Tradition difren bi sey dem no mix am wit Catholic tradishon wey Europeans bring kom. Iya Olga gro insaid dis strong Afro-Brazilian religion fom 1925.

Shi die on September 29, 2005, because of diabetes, an dem bury her for Bosque da Paz Cemetery. Ha fest pikin, Jocelina Barbosa Bispo (wey pipu kol "Jojó"), na shi tek ova afta ha.