Ohuede
Ohuede (c. 1054 – c. 1112) na di twenty-seventh Ogiso (King) of Igodomigodo, one early historical state wey later join becum Benin Empire. E rule from about c. 1110, until im death and e establish wetin later becum di Ohuede dynasty. Im installation as Ogiso happen around c. 1110,, afta di death of Ehenneden wit no clear successor. Im rule last for two years, come end wit di accession of im pikin, Oduwa, in c. 1112. Im reign face economic challenges, governance wahala, and efforts to clear out di dynastic succession law dem.
Background and How E Come Reign
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ohuede bin born around 1054[lower-alpha 1] for Ihinmwirin, one region wey dey inside Igodomigodo (modern-day Benin Kingdom).[lower-alpha 2][1] He be di okaegbe ("family head") of Ogiso Oriagba kin and e be distant relative of Ogiso Ehenneden, as e be di pikin of Oboite—the younger sibling of Ogiso Odoligie and likewise one descendant of Oriagba.[1][3] E don reach di Edionevbo ("senior community chiefs") age grade but e never reach di rank of Odionwere ("senior village chief").[3] Afta Ogiso Ehenneden death wit no heir, di Edionnisen ("kingmakers") track im lineage go Oboite and choose Ohuede as di next ruler.[4] When e be 56, Ohuede na Senior Noble for di Royal Council wey dey represent Ihinmwirin,[1] and im advanced age, noble status, and ancestral link to Ogiso Oriagba all help am get chosen—though questions still dey about di legitimacy of im claim.[5] Ohuede no wan tie im reign with di wider Oriagba family; him choose to separate im rule from di reign of im older relatives inside di kinship group. Im decision to use im own name as di base of one new house later lead to di recognition of wetin dem come know as di Ohuede dynasty.[6]
Di Ughoron ("royal bards") record im ascension wit dis verse:[6]
| Edo | English |
|---|---|
Ohuede n e lhinmwirin, |
Ohuede of Ihinmwirin, |
Reign and gormet
[chenj-am | chenj-am for orijin]When e come reign, Ohuede inherit kingdom wey dey face plenty economic wahala.[7] One of im initiatives na di establishment of Ugbo Owinna ("workers' farms"), wey dem design to give land to artisans and craftsmen so dem fit support dem self.[8] Dis one aim to reduce economic dependency on farming and boost specialisation for trade.[7]
Ohuede still show small interest for governance.[7] E prefer to take im leisure do farming, and e dey orways retreat go im estate or dey enjoy pastimes like to smoke im long pipe.[9] Him absence for court weaken di central authority, allowing Enigie ("Dukes")[lower-alpha 3] to take operate more autonomously. For example, as di capital no dey bring new minister appointments, plenty Enigie begin to collect tolls and duties for trade routes wey pass through dia territories. Dis lack of coordination con cause downturn for trade, both for local and long-distance exchanges. External commerce, especially wit North Africa, suffer as dem face overlapping issues like violent conflict, religious wars, and rampant banditry for di Sahara; all these make di trans-Saharan routes dey more dangerous. Plus domestic disruptions—like declining guild oversight and one apprenticeship system wey don spoil—di economy of Igodomigodo contract, and production standards drop quick.[7]
One notable but controversial proposal during im reign na to extend primogeniture law come allow woman succession if male heir no dey. Though Ohuede get one son—Oduwa—im introduce dis idea as safeguard against future succession wahala, recalling di political uncertainty wey Ogiso Ehenneden death without any heir bring. If Ehenneden get no male sibling like Oboite (Ohuede padi), di realm suppose adopt either rotational system—wey di Senior Nobles favour—or nominate one female relative, wey go trigger bigger controversy. Despite im pragmatic intention, di proposal receive heavy rejection from di Senior Nobles, wey view female succession as too early and no fit di kingdom's patriarchal traditions. Di resistance to woman rule continue, as later when Oba Ewuare try name him daughter, Edeleyo, as successor, dem reject am in similar way.[10]
Death and succession
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ohuede die for 1112 AD, ending im brief reign.[11] E succeed am without dispute by im seventh and only surviving pikin, Idugioduwa, wey become Ogiso Oduwa, and e rule from approximately c. 1112 – c. 1119.[7] Di smooth transition still show say di monarchy na hereditary. However, di death of di six other children before im die stir popular superstitions about im bloodline. Especially, di Ihinmwirin community accuse Idugioduwa mama of witchcraft based on traditional divinations, and dem banish her. Idugioduwa then get raised by him uncle Igbinidu, an ironsmith for Ugboha, one city inside di kingdom.[11]
Legacy
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ohuede legacy still dey debated. One historian Osayomwanbo Ero talk say im reign na one period of institutional decline, im still menshun di weak leadership, economic stagnation, and di erosion of central authority wey Ohuede get.[7] On di other hand, Osarẹn Ọmọregie view Ohuede tenure as one transitional phase in di Ogiso monarchy, especially for di influence im get for debates on succession law.[10] Di Ohuede dynasty na di shortest-lived Ogiso lineage, lasting only two decades before di transition to di Eweka dynasty.[5] Ohuede keep di Delaiso royal salute custom, wey Ogiso Igodo introduce. Di salute mean "di king from di sky" and e don be one long lasting tradition among di Ogiso rulers.[12]
Notes
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Ohuede bin dey about 56 years old when e become Ogiso for 1110.[1] If you subtract 56 from 1110, e show say im birth year be approximately 1054.
- ↑ Di Kingdom of Benin no dey exist as governing entity again, but di Oba of Benin still dey rule one tribal kingdom and dey hold advisory role for di government of Benin City, Nigeria.[2]
- ↑ The Enigie are regional rulers
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]Cite-dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]- 1 2 3 4 Ọmọregie 1997a, p. 68.
- ↑ Parks 2023.
- 1 2 Ero 2003, p. 84.
- ↑ Ọmọregie 1997a, p. 68–69.
- 1 2 Ọmọregie 1997a, p. 70.
- 1 2 Ọmọregie 1997a, p. 69.
- 1 2 3 4 5 6 Ero 2003, p. 85.
- ↑ Ọmọregie 1997a, p. 74.
- ↑ Ọmọregie 1997a, p. 73.
- 1 2 Ọmọregie 1997a, p. 75.
- 1 2 Ọmọregie 1997a, p. 76.
- ↑ Ero 2006, pp. 10–11.
Di wok-dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Ero, Osayomwanbo Osemwegie (2003). The History of Benin: Ogiso Dynasties, 40 BC - 1200 AD. Nosa Computers. ISBN 978-978-31533-7-0.
- Ero, Osayomwanbo Osemwegie (2006). The Philosophy of Edo Morning Salutation (Ukhu). Osun Ero Consult Publications & Sky Ero Communication Associates. ISBN 978-978-37889-7-8.
- Ọmọregie, Osarẹn Solomon Boniface (1997a). Great Benin: The Age of Ogiso Reform (1050-1130 AD). Neraso Publishers. ISBN 978-2734-47-0. OCLC 634055155.
- Parks, Clint (19 October 2023). "The Kingdom of Benin". National Geographic Society. ISSN 0027-9358. Retrieved 16 February 2025.
Kontiniu dey read
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Ọmọregie, Osarẹn Solomon Boniface (1997b). Great Benin: The Age of Ikaladerhan (1130–1200 AD). Neraso Publishers. pp. 13Templet:Ndash14. ISBN 978-978-2734-35-8.