Jump to content

Ogun

From Wikipedia

Ogun or Ogoun (Yoruba: Ògún, Edo: Ògún, Portuguese:Ogum, Gu:Oggun or Ogou) na one Yoruba orisha (god) wey de inside meni Afrika rilijion. Ogun na woriho an im na di spirit wey de kontro mekin of iron. Ogun stil bi di god of palmie or Ogogoro. Pipo sabi Ogun as di god of iron in Yoruba rilijion, Santeria, Haitain ,Vodou, West Afrika Vodun, Candomblé, Umbanda, an di tradishonal rilijion of di Gun pipo. Ogun wan kolet an kontro do throne afta Obatala kpai. Na two times Obatala kontro di throne. Di fest time na before Oduduwa bikom Oba (king) an di sekod time na wey Oduduwa kpai. Ogun no win to bikom di oba (king) bikos Obalufon Ogbogbodirin win am an sent am pakin from di land an mek orda sey mek e leg no rish di land again. Na dis risin mek pipo dey selibret Olójó festiva.

Inside Yoruba rilijion

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For Yoruba rilijion, Ogun na one of di gods wey don tey wel wel. For some aria in Yoruba komuniti, dey bilif sey na Ogun mek way for oda orisha (gods) to fit enta dis earth. Ogun do dis one yuzin axe an with di helep of a dog. For pipo to fit rimemba sey na I'm mek way for di oda gods, dem dey yuz one song to praise Ogun. Di Tahiti of di song na Osin Imole wey mins: di fest of all di god-dem to kom dis earth. Na Ogun bi di gods of war an iron. Wen Ogun stil dey live for di earth day time, pipo tok sey im na di fest oba (king) of Ife. Wen pipo wey de onda am no wan respet Ogun, e fest kpai all of dem with im sword bifor kilin imsef. Na for one ples wey bi Ire-Ekiti Ogun vex enta di ground alive. Bifor Ogun enta di ground alive, e promise sey e go helep eni bodi wey kol im nem for helep. Ogun folowas bilif sey Ogun no kpai but enta di ground alive. Wen Ogun dey alive, e yuz all I'm pawa tek fight an difend di pipo of Ire. Na di risin mek pipo no am as Onire.

Na Ogun bi di tradishonal god wey dey daret woriho, pipo wey dey Kash hanima, pipo wey dey mek metals (iron), an pipo wey dey drive motor. If folowas of Ogun wan swear inside kot, dem go yuz dia mouth bite eni metal (iron) kom tok yuz Ogun nem swear. Pipo wey dey drive motor dey put on some juju for dia bodi so dat dia motor no go get hasidet. Ogun get plenti folowas inside Ogun Stet, Ekiti Stet, Oyo Stet, an Ondo Stet.

Na enitin wey bi iron dem tek dey repiset Ogun. Di oda two tins na palm frond an dog.