Jump to content

Nzambici

From Wikipedia

Nzambici (wey pipo stil sabi as Nzambi) na di evalastin god of neshon as wel as Moon, Earth an di mama sky akordin to Bakongo rilijion bilif. Na Nzambici bi di fimeli part of di Kongo god of kre-a-shon Nzambi Mpungu.

By di time wey 17th senturi wan rish, pipo no kom dey respet or value di impotats of Nzambici again. Wetin pipo dey tok by dat time bi sey smol smol god-dem like Nzambici gada or surround Nzambi Mpungu. Meni pipo wey sabi holdin days tori hagri sey di wey pipo ridus neshon spirit to smol smol spirit hapun bikos di Portuguese pipo bilif sey na onli one god de an as dem no like emeji or idol hafet di bilif of di lokal pipo. Di koko bi sey bifor bifor Nzambici an Nzambi Mpungu bi god wey pipo dey respet wel wel. Nzampi Mpungu komot from Nzambici an bigin to dey live y imsef an dis one mek pipo dey see am as di pawaful kre-a-tor. Dis tori wan risembu di tori wey kristen pipo sef dey tok about God wey Portuguese pipo kari kom.

Kongo tori about di yunivas

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di tradishonal tori wey de for Kongo tok sey in di biginin notin like time, time an space. Na onli one hole dey wey dem kol mbûngi. One day, Nzambi Mpungu, wey bi oga mata mata of all god, komand mek gaya spark. Di nem of di faya na kalûnga. Dis faya kom get pawa an di smoke kom fill mbûngi wey bi di hole. Wen di mbûngi don ova hot som smol smol deti kom skata komot from di hole (mpûngu). Dis deti-dem skata to some time bifor dem kom stop. Wen di deti don kul wel wel, di deti kom form di stars, planet. Na di stars an planet leta form di yunivas. Na dis tori mek Nzambi Mpungu di god of faya an chenj Bikos of sey Nzambi Mpungu no fit stey mek Nzambici no dey im side, Nzambi Mpungu riton to dis earth an kom Mari Nzambici. Wen both of dem dey dis earth, dem mek wota, land, an hanima. Dis one mek Nzambici di mama of di earth, di great tprinses, di mama of all hanima, an di one wey promiss to give an hanima wey fit bring faya wey dey he-vun im gel-pikin.

Nzambici an Nzambi Mpungu kom join bodi kreate di fest Kongo pesin, or muntu. Nzambici stil kom bikom wetin pipo dey opun mouth dey wonda about for dis earth: di mama of all fine gel-pikin, di giva of all kind of law, weyda na for games, musika instrushon. Na Nzambici stil seytu fight bitwin two hanima.