Noah Okafor
Noah Arinzechukwu Okafor (dey bon am 24 May 2000) na one Switzerland professhonal futbol playa wey dey play front for Seria A klub Napoli. Na AC Milan boro Napoli Okafor sey mek e dey play for dem for now. Okafor stil dey play for Switzerland nashonal tim
How im tek start life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Binningen Switzerland dey bon Okafor. E papa kom from Naija an e mama kom from Switzerland. Okafor yonga broda-dem Elijah an Isaiah too bi futbol playa. Elijah dey play for FC Lugano ll an Isaiah dey play for Onda-21 of FC Zürich .
How im tek play futbol
[chenj-am | chenj-am for orijin]Okafor fest start im futbol karia wen e play for di fest young futbol tim FC Aridorf. In 2009, Okafor enta di youth tim of Basel an e play inside all di katigori or levul of di tim bifor e kom enta di sinior tim. Na di 2018-2019 sisin Okafor enta di sinior tim. okafor sahin im professhonal kontat on 31 January 2018. Wen e sahin for Basel sinior tim, na Koch Raphaël Wicky dey koch di tim. Okafor play e fest sinior futbol tim game for Basel on 19 May 2018 wen Basel play FC Luzern. Na wen Mohamed Elyounoussi kari injuri for dat game dem kom kari Okafor enta in di 34 minit of di game. Na 2-2 di game finish. Okafor goal hapun on 28 July 2018 wen Basel play away game with Xamax. Na 1-1 di game finish. Wen Marcel Koller stil bi di koch of Basel, Okafor helep dem win di 2018-19 Swiss Cup kompetishon. Bitwin 2017 go rish 2020, Okafor play 72 games for Basel an total goal na nine. 39 of di game na inside Swiss Supa Ligi, Seven of di game na inside Swiss Cup, Eight of di game na inside UEFA Shampion Ligi, an 18 of di game na inside friendli game. Out of di nine goal wey e get for Basel: 3 goal hapun inside dia Ligi, 2 goal hapun inside Swiss Cup 2 goal hapun inside Europian kompetishon an di rimenin 2 goal inside friendli game.
- Red Bull Salzburg
Okafor sahin for Red Bull Salzburg on 31 January 2922. Di fest goal wey Okafor goal for di klub hapun on 8 December 2021 wen Red Bull Salzburg play Seville. Di game na final grup stage of Shampion Ligi. Na win against Seville mek Red Bull Salzburg di fest klub wey wan kom from Austrian wey komot from grup stage of Shampion Ligi to enta Round of 16.
- AC Milan
Okafor sahin for Italia Seria A side AC Milan on 22 July 2023. Wetin de inside di kontat bi sey Okafor go dey with AC Milan till 30 June 2028. Na for di game wey AC Milan play Bologna on 21 August 2023 bi di fest game wey Okafor wan play for AC Milan. E fest goal hapun in di 3-1 away win wen AC Milan play Cagliari. Afta three days wen e play Cagliari, e sekond goal hapun im AC Milan win against Lazio. Di game end 2-0 win.