Jump to content

Nneka Onyeali-Ikpe

From Wikipedia

Dr. Nneka Onyeali-Ikpe, OON (dem bon am on July 28, 1964) na di Grup Managing Diarekto an Chief Exekutiv Ofisa of Fidelity Bank Plc. Shi join Fidelity Bank as an Exekutiv Diarekto in 2015 an na shi bi di Managing Diarekto/CEO in January 2021, wey mek am bi di fest wuman wey go bi MD/CEO insaid Bank for histri.

How shi stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Nneka Onyeali-Ikpe for Legos, Nigeria. Shi sta for Owerri, Imo Stet, sef. E stodi for Fediral Govmet Girls' College wey dey Owerri, Imo Stet.

Nneka Onyeali-Ikpe get Bachelor of lor fom di Universiti of Nigeria, Nsukka, an Masta of lor fom King's College London. Shi don go exekutiv program for difren institushon lik; Havard Biznes Skul, Di Wharton Skul Universiti of Pennsylvania, an London Biznes Skul. Shi jus finish Diploma program on top organizashon Leadership in Said Biznes Skul, Oxford Universiti, UK. Shi get honorary doctorate digre insaid Biznes Administration fom di Universiti of Nigeria, Nsukka (UNN) an an ofisa of di Order of di Niger (OON), wey Fediral Govmet giv am in 2023.

How shi tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid 1990, shi stat wok insaid bankin as legal ofisa for Bank wey don go Afrika Continental Bank. Shi wok as treasury ofisa for First Afrika Trust Bank. Shi leta join Zenith Bank an Standard Chartered Bank.

Onyeali-Ikpe na Dr Ken Onyeali-Ikpe, PhD, wey Dem sabi wel wel for marketing, Branding, an consumer wok, waif.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]