Nirṛti
Nirṛti na one spirit for Hindu tori. Som pipul dey spel am as Nirruti abi Nirriti. Dis spirit min kpai, tins wey don spoil, and wahala wey dey mek pesin sad. For old Hindu buk dem, Nirṛti na wuman spirit wey dey liv for land of pipul wey don kpai. Bot leta, som Hindu tori tok say Nirṛti fit be man spirit tu. As man, e bi one of di gods wey dey gaid kona for graund – di southwest said.
Wetin di nem "Nirṛti" min
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di wod "Nirṛti" kom from Sanskrit, and e min say somtin don spoil or no dey wok again. E stil min say di ples or di tin no get law, no get oda, evritin jos skata enihau.[1]
Old Hindu buk yuz dis nem tok abaut one ples wey bi laik daknes. For dat kaind ples, lait no dey, fud no dey, pikin no dey. E bi laik ded land wey no laif dey insaid. Enibodi wey no du sakrifais or bon pikin fit go dat kaind dak ples.[2]
Nirṛti as wuman spirit
[chenj-am | chenj-am for orijin]For one old Hindu buk wey dem dey kol Rigveda, dem tok abaut Nirṛti as wuman wey pipul dey beg mek she no ves for dem. For one song for dat buk (X.59), dem beg ha wel wel mek shi komot from wie dem dey du sakrifais.[3]
Anoda buk, Atharvaveda (V.7.9), tok say shi get gold hair. For Taittiriya Brahmana (I.6.1.4), dem diskraib ha as dak wuman wey dey wie blak klot, and wen pipul dey sakrifais giv ha, na blak pat of corn dem dey give.
Anoda holi buk, Shatapatha Brahmana (X.1.2.9), tok say shi dey rul di southwest said of di wold. Bot for anoda pat of di sem buk (V.2.3.3), dem say shi dey liv for land of pipul wey don kpai.
Leta, oda Hindu buk dem tok say Nirṛti na big spirit. Som pipul tok say shi bi waif of Adharma (wey na bad tin or rong way of laif), and na shi bon three spirit-pikin: Mrityu (Det), Bhaya (Fia), and Mahabhaya (Big Fia). Dem dey kol dis three spirit dem “Nairrita”.
Som tori stil tok say Nirṛti bi pikin of Adharma and Himsa (wey min katakata). Shi mari her broda wey dem kol Arita (wey min no law), and dem bon Naraka (hell spirit) and Bhaya (fia).
Anoda Hindu buk, Bhagavata Purana, tok say Nirṛti no get pikin, bot e tek Adharma and Mrṣā (lai-lai) as pikin wey e adopt.
Som oda buk stil kol Nirṛti sem as Jyestha or Alakshmi, bad-lok woman god. Dem say shi kom out from wen gods and demons dey ton ocean (wey dem dey kol Samudra Manthana).
Nirṛti as god wey gaid dareshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Som pipul biliv say di wuman spirit Nirṛti leta ton to man god. As man, e bi dikpala, wey min god wey dey gaid dareshon. Nirṛti dey gaid di southwest said.
Som buk tok say dem join Nirṛti as one of di rudra gods, and e bi pikin of one god wey dem dey kol Sthanu.
For difrent Hindu buk, dem diskraib Nirṛti difrentli. Som buk say Nirṛti get dak skin, big bodi, and e dey wie yellow klot. E fit raid man abi lion.
Vishnudharmottara Purana tok say Nirṛti fez wiked wel wel: e get bad ai, big maut, and show tit. Anoda pat of dat buk tok say Nirṛti dey raid donki and e dey hold one big stik for hand.
Di buk olso tok say Nirṛti get four waif: Devi, Krishnangi, Krishavandana, and Krishnapasha.
Devi-Bhagavata Purana tok say Nirṛti dey liv for one siti wey dem kol Krishnajana, wey dey for southwest of one big monten wey dem kol Mount Meru. Di siti big wel wel – e dey kova 2500 yojanas (dat na Hindu way to mesho land).[4]
Wie dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Witzel, Michael. “Macrocosm, Mesocosm, and Microcosm: The Persistent Nature of 'Hindu' Beliefs and Symbolic Forms.” International Journal of Hindu Studies, vol. 1, no. 3, 1997, pp. 501–539. JSTOR, www.jstor.org/stable/20106493. Accessed 20 April 2025.
- ↑ Chandra, Suresh (1998). Encyclopaedia of Hindu Gods and Goddesses. Sarup & Sons. ISBN 978-81-7625-039-9.
- ↑ Margaret Stutley (2019-04-09) [1977]. A Dictionary of Hinduism. London: Routledge. p. 210. ISBN 978-0-429-62754-5. OL 35543927M.
- ↑ Mani, Vettam (1975). Puranic encyclopaedia : a comprehensive dictionary with special reference to the epic and Puranic literature. Robarts - University of Toronto. Delhi : Motilal Banarsidass. pp. 62, 540.