Ngozi Chuma-Udeh
Ngozi Therese Chuma-Udeh na Naija profesor wey sabi English wel wel, espeshialy for Afrika literature an how e tek kompare wit oda literature, poet, an pesin wey dey faight for wumen an children raight.
Shi don wok for University Orator for Anambra Stet University wey demleta chenj di nem to Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University fom 2012 go rish 2017. Right nau, shi bi kommissioner for Edukeshon for Anambra State and shi stil bi Secretary for Anambra State Education Advisory Board.
How shi tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Chuma-Udeh go University of Port Harcourt, wia shi stodi English Language an Literature. Leta, shi kontinue for Nnamdi Azikiwe University, wia shi get Master's degree (M.A.) an PhD for English an Comparative Literature.
Ha wok life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Chuma-Udeh na fiction editor for Sentinel Literary Quarterly wey dey United Kingdom. Shi don sarf as head of English Department for Anambra State University two taimes. Shi don wok as Coordinator for General English Studies, Associate Dean for Faculty of Arts, an leta shi bi Dean for Faculty of Arts. Shi even chair kommitee wey arenj international conference for dia Faculty of Arts.
Ngozi na stil editor an reviewer for PMLA Journal of the Modern Language Association, MLA an shi dey wok wit oda akademic journals lik ANSU Journal of Integrated Knowledge an ANSU Journal of Arts an Social Science.
On April 11, 2022, Anambra State Governor, Prof. Charles Chukwuma Soludo, appoint Chuma-Udeh as Commissioner for Education. Wen shi stat wok, shi first meet staff of Ministry of Education an difren edukeshon boards to tok how education for Anambra go improve.
For 2023, as shi wok wit tichers for Anambra, shi tel Head Tichers sey mek dem tich chuldren gud way to bihav an morals, an also dey pray wit dem everi taime.
Som of di buks an artikus wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Academic Articles***
She don rait plenti artikus abaut African literature, jostis, wumen raights, an social issues insaid difren akademic journals.
Buks wey shi don Poblish
[chenj-am | chenj-am for orijin]"Caribbean Literature
- Perspectives on Shakespeare
- English Studies: Facts, Patterns, an Principles (with Ifejirika Echezona)
- Trends and Issues in Nigerian Literature
- Fiction
- Forlorn Fate (Wetin dey hapun for Niger Delta)
- Ojadili (Igbo epic stori wey shi translate)
- The Presidential Handshake
- Dreams of Childhood
- Chants of Despair (Poetry collection)
- The Journey of Faith (Drama wey Catholic Women Organization use for 2010 conference)
- Echoes of a New Dawn
- Teachers on Strike
- Children Books
- The Escape of Amara
- Amara The Little House Help
- The Rescue of Amara
- Amara Goes to School
Awods wey shi don win
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Best Performing Commissioner for Education for South East Nigeria (by Schools Debate Nigeria)
- 2022 Eminent Personality Award
- West African Award for Contemporary Children's Fiction
- Association of African Women Writers' Masterpiece Award (2010, Dakar, Senegal)
- West African Writers' Children's Literary Renaissance Award (2005, Takoradi, Ghana.
Chuma-Udeh na one wuman wey don du plenti thins for edukeshon an literature, an shi stil dey wok hard to mek edukeshon for Anambra an Nigeria beta.