Nasir Idris
Mohammed Nasir Idris (wey dem bon for 6 August) na Naija union pesin (unionist), edukeshon expert, an politishan. He dey sarf as di korent govenor of Kebbi State. Bifor nau, e don sarf as nashonal president of the Nigerian Union of Teachers (NUT) and deputi president of the Nigeria Labour Congress (NLC). For 17 April 2023, Independent National Electoral Commission (INEC) anous say Idris na di winna of di 2023 Kebbi State govnor eleshon.
Earli laif and Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Nasir Idris wey dem bon for 6 August 1965, for Birnin Kebbi lokal govment aria for Kebbi State. E go The Polytechnic Birnin Kebbi fom 1994 rish 2003. Leta, bitwin 2006 and 2009, e go Usmanu Danfodio University, Sokoto, to get im MBA (Master degree for business). Idris stil get PhD for Education, and e don rait plenti buk wey dey explain school mata ontop skul.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2018, Idris win eleshon wey mek am bi president of Nigeria Union of Teachers (NUT) and di deputy president of Nigeria Labour Congress (NLC). E don sarf bifor as NUT chairman for Kebbi State, NLC chairman for Kebbi State, and National Treasurer for NUT.
For May 2022, Mr Idris win di All Progressives Congress (APC) primari election for Kebbi State, kom bi di parti govnorship candidate. For 17 April 2023, INEC tok sey Idris na di winna of di 2023 Kebbi Stet governor eleshon.