Naijeria, Wi Hail Dee
Kontri | Naija |
---|---|
Language of work or name | Nigerian English |
First line | Nigeria we hail thee, our own dear native land, |
Last line | And so with peace and plenty Nigeria may be blessed. |
"Naijeria, Wi Hæil Dee" bi di foma nachonal antem of Naijeria, wey dey in yuz from independens for 1960 until 1978. Di present antem of Naijeria, "Arais, O Kompatriots," dey in yuz from 1978, and replaes "Naijeria, Wi Hail Dee."[1]
Histori
[chenj-am | chenj-am for orijin]"Naijeria, Wi Hail Dee" been dey in yuz as di fes nachonal antem for Oktoba 1, 1960.[2] Lilian Jean Wiliams, wey bi wan British expatriaet wey dey liv for Naijeria wen dem grant am independens bi di pesin wey kompoes di liriks of di antem.[2] Frances Berda kompoes di miuzik for "Naijeria, Wi Hail Dee."[2]
Di sekond nachonal antem, "Arais, O Kompatriots," replaes "Naijeria, Wi Hail Dee" for 1978.[2]
Liriks
[chenj-am | chenj-am for orijin]Naijeria wi hail dee
awa own dear netiv land
Though traibs and tong dey difa
In brodahud wi stand
Naijerians aul, dey praud to sav
Awa sovereign Modaland.
Awa flag ga bi a simbol
Say trut and justis reign
In peas or batul honour'd,
And dis wi kaunt as gain,
To hand on to awa pikin-dem
A bana witaut stain.
O God of aul kreashon
Grant dis awa wan request.
Hep us to biuld a neshon
Whe no man dey oppresd
And so wit peas and plenti
Naijeria fit dey blesd.
Kriticisim
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen "Naijeria, Wi Hail Dee" fes dey anaunsd, di niu nachonal antem fais kriticisim for a nomba of reasons. Di Deili Savis, wey bi newspaepa wey Yoruba oganaizashon Egbé Ọmọ Odùduwà dey prodius, start a rebelious kampaign against di nachonal antem, wey risolt to di fomaeshon of a komiti to kolet signaechos as a petishon.[3]
Referens
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Naijeria Nachonal Antem Komposa, Pa Ben Odiase, kpai". Gazele News. 2013-06-12. Archived from the original on 2017-09-27. Retrieved 2024-01-31.
- ↑ 2.0 2.1 2.2 2.3 "Gudnait, Pa Benedit Odiase (1934 – 2013)". National Mirror. 2013-06-30. Archived from the original on 2013-07-04. Retrieved 2024-01-31.
{{cite news}}
: CS1 maint: unfit URL (link) - ↑ Mphahlele, Ezekiel (1960). "Naijeria on di Eve of Independens". Afrika Today. 7 (6): 4–6. JSTOR 4184128.