Jump to content

Mudasiru Oyetunde Hussein

From Wikipedia

Mudasiru Oyetunde Hussein na Naija politishan wey represent di Alliance for Democracy for two times (1999–2007) for the Huas of Rep.[1] E win eleshon for Senator for Osun West for Osun State, Nigeria for the April 2011 nashonal eleshon, e waka wit di Action Congress of Nigeria (ACN) party.

Dem bon Hussein for Ejigbo for Osun state.[2]

Politikal wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hussein get chans to bi representativ for Oshodi-Isolo inside Lagos State for 1999 as memba of di Alliance for Democracy parti, and im kom bak again for anoda time for 2003.[1]

For February 2004, Mudasiru Hussein tok say Haus fit ask President Olusegun Obasanjo to tel wia e tek N360million wey dem tok say dem yuz for nok down ol tol gates for di kontri.[3] For November 2004, Hussein talk say as military people dey enter politics more, e go make democracy strong and steady.[4]

For June 2005, Mudasiru Hussein tok say to find wu kil one impotant moni giva for Oranmiyan grup, Alhaji Hassan Olajokun, na to mek shwo Naija niu democracy go last.[2] Dat same month, Mudasiru Hussein tok say fayit to get more kontrol for risosis go stop if "Mineral Resources Commission Bill" pas, bikos dat one go allow rijons kontrol dia own tins.[5] For January 2006, Mudashiru Hussein talk say Nigerian constitution no allow President Olusegun Obasanjo make him do third term.[6] Wen e contest for Action Congress for 2007 senate eleshon for Osun West, e luz to Isiaka Adetunji Adeleke. Hussein fayit di eleshon rizot, e show video wey show as bad men dey kari ballot boxes away and votas dey fie for dia life, bot kot no chenj rizot.[1][7]

For April 2011 senate eleshon for Osun West, Husain get 121,971 votes, and Senator Adeleke from PDP kom sekond wit 77,090 votes.[8]

Afta Senator Isiaka Adeleke kpai, e kontest again for bye eleshon for 2017 wit All Progressives Congress. E luz to Ademola Adeleke wey bi di yonga broda of di senator wey don kpai and pipul sabi am as "dancing senator".[9][10]

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. 1 2 3 "AC Senatorial Candidate boasts: I'll flush Adeleke out of Senate". The Daily Sun. 28 August 2008. Retrieved 2009-09-20.
  2. 1 2 "Lawmaker Challenges Police over Slain AD Chieftain". This Day. 18 June 2005. Archived from the original on 2011-07-07. Retrieved 2009-09-20.
  3. "Toll Gates: N/Assembly May Invite Obasanjo Over N360m". This Day. 10 February 2004. Retrieved 2009-09-20.
  4. "'Military in Politics Good for Stability'". This Day. 16 November 2004. Archived from the original on 2005-01-28. Retrieved 2009-09-20.
  5. "House to Pass Mineral Resources Bill". This Day. 27 June 2005. Retrieved 2009-09-20.
  6. "Lawmaker Dismisses 3rd Term Agenda". This Day. 1 January 2006. Archived from the original on 2011-07-07. Retrieved 2009-09-20.
  7. "'How Police Aided Politicians to Rig'". This Day. 7 March 2008. Retrieved 2009-09-20.
  8. "Official result of OSUN Senatorial Elections". The Punch. 10 April 2011. Archived from the original on 2011-04-13. Retrieved 2011-05-05.
  9. Online, Tribune (2017-06-26). "Osun West bye-election: My pedigree will earn me victory —Hussain". Tribune Online. Retrieved 2022-09-22.
  10. "Who is Senator Mudasiru Oyetunde Hussein?". SOJ WORLDWIDE. 2017-06-17. Retrieved 2022-09-22.