Moses Bliss
Moses Uyoh Enang (dey bon am 20 February 1995) wey pipo sabi wel wel as Moses Bliss na Naija gospel singa an song-raita.Na Moses Bliss bi di fonda of Spotlite Nation, one Naija rekod level. Bliss rilis e fest singuin January 2017 an e kol am: E no dey fall my hand. Na one song wey e rilis in 2017 mek Bliss popula wel wel. Di nem of dat song na: Too Faithful .
For 2020, Chris Oyakhilome chorch, give am awod for e song You I live for. Di nem of di awod na: Loveworld International Music and Arts Award, (LIMA 2020).
How e tek put bodi for muzik
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na wen Bliss stil bi smol pikin e don like muzik wel wel. Wen Bliss bi five year, e don sabi play some muzik instrumet. Leta, Bliss join di kwaya of Believers' Loveworld Church. Bliss ofisha enta muzik bizness wen e rilis di song E no dey fall my hand in 2017.
In 2018, Bliss rilis di song Too Faithful an folo am up with anoda singu Bigger everyday. Bliss fest habom, Top Faithful kom out in May 2021. For dat e fest habom, na 13 song de inside. Top Faithful habom get song like:
- Taking Care
- Perfection, an
- E no fall my hand .
For February 2023, Bliss rilis e sekod habom wey bi More Than Music . Di sekod habom sed get 13 habom.
Symphonic Distribution sahin Bliss onda dia muzik lebel in October 2021. Na Florida in United State Symphonic Distribution ofis de.
Bliss opun e own muzik label kompini in February 2023. E nem am: Spotlite Nation. Bliss sahin four different muzishan for di rekod lebel. Dia nem na:
- Chizie,
- Festizie,
- Doris Joseph, an
- Grace Lokwa.
Evri year, Bliss dey arenj for one muzik show wey e nem: Bliss Experience .
How e tek put bodi for bizness
[chenj-am | chenj-am for orijin]Bliss put hand into klotin bizness. Bliss klotin bizness shop de for Abuja. Di nem of e klotin bizness na Shades of Bliss, an na onli man klotin e dey sel==E pasonal life== In Januay 2024, Bliss tell pipo sey e go mari Marie Wiseborn. Mary Wiseborn na one ledi wey kom from Ghana but e dey live for London. Na lorya work Marie Wiseborn dey do.
Di marej bitwin Bliss an Marie Wiseborn hapun on 3 March 2024.