Jump to content

Molara Wood

From Wikipedia

Molara Wood (wey dem bon for 1967) na Naija wuman wey sabi rait tori, shi bi jonalist, an she dey riviu art and buk dem. Plenti pipul sabi ha as one of di big vois for Art an Kolsho wok for Naija.

Ha shot tori dem, kwik-kwik tori (flash fikshon), poem, an atikul dem don show for plenti buk an online magazin dem. Di list inklud African Literature Today, Chimurenga, Farafina Magazine, Sentinel Poetry, DrumVoices Revue, Sable LitMag, Eclectica Magazine, The New Gong Buk of New Naija Short Tori (wey Adewale Maja-Pearce edit for 2007), an One World: A Global Anthology of Short Stories (wey Chris Brazier edit for 2009). Shi dey liv for Lagos nau.[1]

Ha tori smol-smol

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Molara Wood for Ilase-Ijesa for Osun State, Naija.[2] Shi tok say ha laif na "somtin laik waka-waka laif", as shi don liv for plenti difren ples dem. Shi spend 20 yias for Britain (UK), ivun do say ha plan na to stay for 3 or 4 yias onli. Shi tok say, “Laif jos dey hapun. Yu no go sabi wen di yia don dey pail up, sotey one day yu go opun eye, 20 yias don pas.”

For one 2015 tok wit Oyebade Dosunmu for Aké Review, shi stil tok say ivun bifo shi waka go UK, shi don liv for not an saut-west Naija, and ivun for Los Angeles. For di time wey shi rich 11 or 12 yias, shi don test plenti ples. Shi tok say shi dey olways fil laik pesin wey no dey rili bilong for one ples. Ivun wen shi kom bak to Naija, di filin stil dey, e jos chenj stai. Pipul dey tok say shi bi laik pesin wey jos kom from "away", ivun wen shi trai blend.

Shi say di taim wey shi spend for London hep ha si wetin dey shele for Naija pipul wey dey live abrod. E opun ha eye to dem soga-hed and how dem dey trai sovaiv for anoda man kontri.

For 2007, dem komend ha tori for di Commonwealth Broadcasting Association Short Story Competition.

For 2008, shi win di first John La Rose Memorial Short Story Competition.

Afta shi riton Naija, shi wok as Arts and Culture Editor for Next Newspaper (wey stop for 2011). Shi kon dey rait kolom for The Guardian newspaper for Lagos.

For ha taim for Next, shi edit Teju Cole own Letters to a Young Writer series. Shi dey blog tu.[3]

Ha buk of shot tori, Indigo, kom out for 2013, na Parrésia Publishers poblish am.

Indigo risiv beta riviu. One riviu from Critical Literature Review tok say di buk na ril joi to rid.

Oyebade Dosunmu write say di tori dem na abaut pipul wey dey live "for between" - pipul wey dey fez palava laik imigreshon, kolsho miks-op, an trai klaimb beta levul for laif. Di tori dem show wetin dem dey face - like wuman wey no fit bon, wuman wey wan shine, krez, abi ivun det. All di tori show hau dem dey trai balans for di kind laif wey dey shek laik sand.

Meni of di tori tok abaut African wuman laif - laik wuman wey no fit get pikin, man wey get plenti wife, an wuman wey ha hosband don kpai.

Molara Wood tok say: “Dis rait-op dem na from wumanist an feminist pesin. I dey fil wetin wuman dey pas tru for bodi. I no dey si man raita dem dey rait abaut am wel, so na wi, di wuman raita dem, go show di ril vois of wuman.”

Shi bi joj for 2015 Etisalat Prize for Literature. Shi dey for Advisory Board of Aké Arts and Book Festival. Shi don join meni buk an art festival dem, like Lagos Buk & Art Festival.

Tori wey no tu tey

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2022, dem selekt ha as raita-in-residens for Library of Africa and the African Diaspora (LOATAD) wey dey Accra, Ghana.[4]

Indigo (shot tori dem), 2013

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. Murua, James (2020-01-08). "Molara Wood appointed Chief Editor at Ouida Books, One Read Africa". Retrieved 2025-04-20.
  2. "I have an atrocious memory —Molara Wood". tribuneonlineng.com. Nigeria. 31 July 2016. Retrieved 20 April 2025.
  3. "words follow me". words follow me (in Ínglish). 27 October 2010. Retrieved 20 April 2025.
  4. "Library of Africa and African Diaspora Announces West African Writer Fellowship Residents". Nigeria Abroad. 25 February 2022. Retrieved 20 April 2025.